Fubara react to Rivers State House of Assembly impeachment process against am, tok why im bin dey silent

A man seated at a table - a mic is before him

Wia dis foto come from, Sir Siminalayi Fubara/Facebook

Read am in 3 mins

Rivers State Govnor Siminalayi Fubara don ask di pipo of di state to calm down ova di ongoing impeachment process wey di House of Assembly initiate against am and im deputy on Thursday 8 January.

For di church service wey dem hold to mark di 2026 Armed Forces Remembrance Day, Govnor Fubara assure pipo of di state say evritin go dey alright.

BBC News Pidgin bin report say di political crisis for Rivers State get anoda twist as members of di State House of Assembly begin impeachment proceedings against di Govnor and im deputy, Ngozi Odu.

E hapun during plenary wey dey presided over by Speaker of di Rivers State House of Assembly, Martin Amaewhule.

Majority Leader, Rivers State House of Assembly, Major Jack, read out di notice of allegations and gross misconduct against Fubara.

Govnor Fubara tok say im decision to remain silent in di face of distractions bin dey deliberate, and add say e dey draw strength from im faith in God.

On di oda hand, Prof. Ngozi Odu, say make pipo maintain good conduct, in line wit di admonition of di Dean of di Anglican Communion, Archbishop Blessing Eyinda, wey tok during im sermon say evri action go dey remembered at one time or anoda.

She also appeal to di pipo continue to uphold di administration in prayer, as she tok say na di support be di pillar wey dey sustain di govment.

Breakdown of relationship between Wike and Fubara?

Dis latest development of di impeachment proceedings wey di state assembly don begin dey follow weeks of activities wey show say di relationship between di Rivers State Govnor Siminalayi Fubara and di FCT Minister Nyesom Wike don break down.

Di FCT Minister Nyesom Wike during im 'Thank-You tours' across di 23 local govment areas of di state to appreciate political leaders, party officials and grassroots supporters for di area for dia loyalty bin give hint.

E say gratitude and accountability na di foundation of enduring political relationships and accuse Govnor Fubara say e dey ungrateful and e neva honour all di agreements dem reach afta di lifting of di state of emergency and reconciliation.

Wike for one of di tours to Asari Toru LGA say: "Wen a man make a mistake and come back to say, 'I dey sorry, I make mistake,' dat mistake fit dey corrected. No propaganda, no shouting and no battle fit solve problems. Only accountability and correction fit."

Wike say e don begin rainbow coalition wey go produce all elective positions for di state for di 2027 elections.

Di rainbow coalition e dey tok about na di APC and PDP working togeda to produce winners for di election, like di model for di last local govment election wia im loyalists in di APC win 20 local govments of di 23 LGAs, while PDP only win just three local govments.

"Here, we no dey focus on political parties. Wetin we get na family, rainbow coalition. If you no belong to dis family, forget am. Afta di president, na dis family go determine di direction of di state," Wike bin tok.