Prime Minister Mark Carney plan for Canada Immigration

Mark Carney speaking in front of a microphone while pipo dey im back

Wia dis foto come from, Getty Images

Read am in 5 mins

Canada Prime Minister Mark Carney and im Liberals party say e dey important to implement policies wey go address challenges wey di kontri dey face in terms of immigration.

Di Prime Minister say while dem go maintain di kontri as a welcoming nation, Canada no go allow make immigration levels overpower dia housing, healthcare and jobs.

Dem swear-in Mark Carney as Canada Prime Minister for March 2025, and during im campaign, e say di kontri gatz return back on track sake of how immigration increase under di former govment of Justin Trudeau.

Canada say immigration dey place pressure on dia social services, housing and healthcare and di Liberals party under Carney wan address dis issues while dem go also ensure say di system dey benefit Canada economy.

For im press conference on May 3, 2025, Canada Prime Minister say im govment dey take action to bring immigration to "sustainable levels" by 2027.

"As I dey warn for months, America want our land and resources. Neva. Dis no be threat, Trump dey try break so America fit get us, but dat no go happun," Carney tok for im address.

Carney say im go represent di interest of evri Canadians regardless of wia dem dey and who dem support.

How Canada wan address immigration

  • Annual immigration target

For 2024, Canada govment bin announce new immigration plan wey go reduce di number of international students and foreign workers. Dis na under di previous govment.

Howeva, one of di ways wey di Liberal Party under Carney dey look immigration policy na to stabilize how dem admit permanent resident (PR) into di kontri.

Dem wan keep permanent resident admission for less dan 1% of Canada population annually beyond 2027.

Dis na part of di current Immigration Levels Plan for 2025-2027, wey put permanent residents targets for 395,000 in 2025, 380,000 in 2026, and 365,000 in 2027.

For di next two years (2025-2027), Canada say dem wan see reduction for dia population, and to cut immigration na one of di ways.

For di immigration plan document, Canada say "we dey reduce from 500,000 permanent residents to 395,000 for 2025; reduce from 500,000 permanent residents to 380,000 for 2026 and set a target of 365,000 permanent residents for 2027."

Dis na policy wey di former Immigration Minister Marc Miller bin introduce for 2024 and di Carney govment intend to kontinue dis approach.

According to di Liberal party, di stability of annua immigration go create a system wey go reduce di pressure ontop public services by newcomers and long-term residents.

  • Addressing temporary residents

Canada temporary resident population don grow in recent years, and e don raise discussion. Dis temporary residents include international students, foreign workers, amongst odas.

Na last year di previous govment first announce to reduce temporary residents, but now, di Liberals Party under Prime Minister Carney don reinforce dem go reduce temporary residents for Canada.

As of January 2025, report according to Immigration News Canada say an estimate of 3.02 million temporary residents wey include international students, temporary foreign workers bin make up di about 7.25% of Canada population of 41.5 million pipo.

Di Liberal Party pledge to reduce dis proportion to less dan 5% by di end of 2027 and dem describe am as "sustainable levels."

How dem wan do dis na to do transition of temporary residents to permanent residency while Canada go also allow some residents to leave as dia permit dey expire.

Dis method of reduction include putting limit to study permit applications, to increase eligibility for Post-Graduation Work Permits (PGWPs), and stop Spousal Open Work Permits (SOWPs).

"Immigration caps go remain until we expand housing and understand di levels of immigration wey don happun for our kontri [during di pandemic]," Mark Carney say.

  • Study and work permits

Dose wey alreadi for Canada as temporary residents, such as international students and workers, fit benefit from di process to become permanent residency.

Howeva, new applicants for study permits or work permits fit face more strict criteria and caps and make am more competitive to enta Canada.

For Canadians, di Liberals plan to address concerns about housing and public services to ensure say immigration levels dey in line wit infrastructure capacity.

Di reduction in temporary resident levels na to reduce pressure ontop Canada resources.

Carney say im govment go work wit evrione wey dey Canada and make oda parties put aside hatred as dem go do well to build.

"Dis na Canada and we go decide wetin go happun for here. We gatz build more houses using Canadian skilled workers and indigenous pipo," Carney tok.

  • Increasing francophone immigrants

Mark Carney dey target francophone immigrants outside of Quebec by 12% in 2029.

Dis go help wit di federal targets of 8.5% in 2025, 9.5% in 2026, and 10% in 2027.

Di aim na to bolster French-speaking communities outside Quebec and address demographic and labour needs within minority francophone regions.

  • Support global skills

Mark Carney tok say dem go revamp di Global Skills Strategy to help "attract top global talent."

Di Global Skills Strategy na federal program wey dey help eligible Canadian businesses hire skilled workers from around di world, wit priority work permit wey dem fit process within two weeks.

Dem also wan launch new projects wey fit help high-growth Canadian businesses and entrepreneurs attract new talent. E also mention say dem dey intentional to draw highly skilled workers from di US, into Canada.

Di goment intend to work wit provinces and territories to streamline and speed up recognition of foreign credentials and international professional experience.