Mark Carney sworn in as Canada new prime minister - List of im key cabinet appointments

Wia dis foto come from, Getty Images
Dem don officially swear-in Mark Carney as di 24th Prime Minister of Canada.
Carney replace Justin Trudeau wey resign as Prime Minister and Liberal Party leader sake of political division for di party.
Carney arrive Rideau Hall in Ottawa wia e sign documents wey Governor General of Canada, Mary Simon also sign and now e don become di prime minister of Canada.
As di traditional be for Canada, dem swear in Carney for both official languages - English and French and e recite an oath swearing allegiance to King Charles III, King of Canada, as well as im heirs and successors.
Carney promise say im go dey "faithful and true servant to im majesty".
Bifor Carney bin officially sign di documents wey make am Prime Minister, e tell tori pipo say im dey get straight to work.
"We be veri focused govment, focused on action. We dey go straight to work."
During di swearing-in, di secretary to di govnor general, Ken MacKillop startb y acknowledging traditional elders for di ceremony and introduce a first nation speaker - Elder Verna McGregor.
Na Canada Clerk of di Privy Council, John Hannaford, bin open di ceremony as seats dey filled quickly wit some notable faces wey fill di room.
Former governor generals of Canada and former Liberal Prime Minister Jean Chretien bin dey in attendance as well as members of Carney family including im wife Diana Fox wey siddown for front row.
Mark Carney bin meet im wife, Diana Fox Carney - a British economist wey focus on developing kontri, while di two of dem dey study for di University of Oxford in England.
Diana previously serve as di vice president of Canada 2020, one progressive think tank wey dey conduct research and start conversations about di future of di kontri.
DI couple marry for 1994 and dem get four daughters togeda.
Na about 30 minutes bifor di swearing ceremony of di new Prime Minister, na im di outgoing Prime Minister Justin Trudeau bin officially resign as Canada Prime Minister.
Trudeau meet wit Governor General Mary Simon bifor e officially resign.
Outgone Canadian Prime Minister Justin Trudeau bin first announce im resignation for one press conference on Monday 6 January 2025.
E reveal say im bin make im decision to resign afta long tok-tok wit im family and e dey also step down as Liberal leader.
Trudeau become Liberal leader for 2013 wen di party bin dey inside big gbege wey land am for number three position for di House of Commons for di first time.
Carney key cabinet appointments
Cabinet ministers for di new prime minister administration also dey sworn-in.
- Minister of Foreign Affairs Minister - Melanie Joly retain her positions despite serving in Justin Trudeau cabinet.
- Minister of Democratic institutions - Arielle Kayabaga
- Minister of Agriculture - Kody Blois
- Minister of immigration, refugees and citizenship - Rachel Bendayan
- Dominic LeBlanc wey previously be di finance minister, is now di minister of international trade and intergovernmental affairs.
- Minister of finance - Francois-Philippe Champagne, e bin previously serve as minister of innovation, science and industry of Canada
- Minister of national defence - Bill Blair
- Minister of energy and natural resources - Jonathan Wilkinson
- Minister of transport and internal trade - Chrystia Freeland, she bin serve as Canada former finance minister and deputy prime minister bifor she resign for December but now back
- Steven Guilbeault don move from im previous post as environment minister, and now handed di file for Canadian culture and identity, Parks Canada and Quebec lieutenant.
- Minister of environment file - Terry Duguid, a Winnipeg MP and di previous minister of sport
Who be Mark Carney?
Mark Carney na di first non-British pesin to become Govnor of di Bank of England in more dan 300-year history wen e take di job for 2013.
Im bin previously lead in kontri through di Great Recession as di govnor of di Bank of Canada wey be di kontri central bank bifor e chook eye for Britain top banking job.
But unlike most prime ministers, Carney neva hold any political office bifor. Upon dat, e win di contest to replace Justin Trudeau.
Now, e must lead di kontri through one of im toughest challenges wey be di trade war wit dia biggest trading partner, di United States.









