Canada Prime Minister Justin Trudeau and im wife Sophie dey separate

Sophie and Justin Trudeau

Wia dis foto come from, PA Media

Canada Prime Minister Justin Trudeau don announce separation from im wife Sophie.

Trudeau and im wife Sophie dey separate afta 18 years, following "meaningful and difficult conversations." di PM post for im social media account.

Dem bin marry for Montreal for 2005 and get three children togeda.

For one statement, Oga Trudeau office tok say although di couple don sign separation agreement, dem go still dey make public appearances.

"Dem dey work to make sure say dem don take all legal and ethical steps wey concern dia decision to separate, and dem go continue to do so moving forward," di statement tok, and add say dem dey go on holiday as a family next week.

Di couple don ask for privacy for di "well-being" of dia children, Xavier, 15, Ella-Grace 14, and Hadrien wey be 9 years old.

"We remain a close family wit deep love and respect for each oda and for everytin we don build and go continue to build. Oga Trudeau wey be 51-year-old and Madam Gregoire wey be 48, bin tok."

In recent years, pipo no too dey see dem togeda for public, though dem bin attend di coronation of King Charles III togeda for May and host di US President Joe Biden in Canada for March.

Sophie and Justin Trudeau

Wia dis foto come from, Getty Images

For one wedding anniversary post on Instagram in May 2022, Madam Gregoire Trudeau bin write about di challenges of long-term relationships, she say "we don navigate through sunny days, heavy storms, and everything in between".

Di two bin start to date for 2003, when Madam Gregoire Trudeau bin dey work as TV personality.

Pipo sabi her for her charity work around mental health and eating disorders.

Dem first elect Oga Trudeau as prime minister for 2015.