Lizzo, body positivity artiste dey face fat-shaming lawsuit

Wia dis foto come from, Getty Images
Three formers dancers of pop star Lizzo don sue her on top accuse of sexual harassment and hostile work environment.
Di lawsuit wey dem submit on Tuesday get accuse of sexual, religious and racial harassment, discrimination, assault and false imprisonment.
Arianna Davis, Crystal Willams and Noelle Rodriguez na di former dancers wey collabo bring di lawsuit come.
Di lawsuit wey dem bin file for Los Angeles bin include accuse say dem "force dem to face sexual behaviour" and bin dey "pressured to participate for disturbing sex shows" between 2021 and 2023.
Among di accuse wey Lizzo - wey her real name be Melissa Viviane Jefferson - dey face na one wia she "pressure Ms Davis to touch di breast" of one performer for one nightclub for Amsterdam and Ms Davis afta she try dodge finally gree sake of say she bin "fear say say e go affect her future for di team" if she no do am.
Lizzo, wey dey popular say she dey celebrate her bodi and self love, dey accused togeda with her dance choreographer Tanisha Scott say she weight shame Ms Davis for tour.
Ms Davis say di two of dem ask weda she dey "struggle with sometin as e be like she no commit to her role for di dance cast," na wetin di lawsuit tok.
Even though dem no tok am koro koro, di question "make Ms Davis feel like she gatz explain her weight gain and tok personal tins about her life so she go keep her job", according to di lawsuit.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di lawsuit add say di dance team captain, Shirlene Quigley push her Christianity on performers and bin dey yab pipo wey dey do premarital knacks.
She also comot dey tok about one of di former dancers' virginity and even post am for social media.
Dem bin hammer accuse of racial discrimination on top di management team of di production company, Big Grrrl Big Touring, Inc.
Dem say di black members of di dance team bin dey "treated differently" to oda members for di team.
Di lawsuit claim say dem accuse dem say dem dey "lazy, unprofessional and say dem get bad attitude" and no be di way dem treat oda dancers.

Wia dis foto come from, Getty Images
Dem also accuse say Lizzo and di production company team no pay dem fairly for parts of Lizzo European tour.
Dem claim say dem only give dem 25% of dia weekly money wen dem bin no dey perform for di tour while oda perfromers collect 50% and also claim say dem no suppose work for oda projects while dem dey di tour.
Two of di three dancers wey dey inside di lawsuit, Ms Dais and Ms Williams bin meet Lizzo for March 2021 as dem bin dey prep to compete inside di reality TV show, Lizzo's Watch Out for the Big Grrrls, according to di lawsuit.
Ms Rodriguez wey be di third for di suit bin dey employed for May 2021 to perform inside Lizzo music video for di song Rumours. Di lawsuit say afta di shoot, she continue for di dance troop.
Ms Davis and Ms Williams bin dey fired from di dance team, while Ms Rodriguez comot by herself ova di alleged way dem treat her colleagues.
Who be Lizzo?

Wia dis foto come from, Getty Images
Lizzo, wey her real name na Melissa Viviane Jefferson na pesin wey dem born for Detroit, US and bin study classical flute performance for di University of Houston.
She bin release her first studio album wey she call Lizzobangers for October 2013 but no be until 2019 wey she go blow well-well.
In fact Truth Hurts na song wey she bin drop for September 2017 and e take full two years for am to enta top of di charts for di Billboard Hot 100.
For January 2020, Lizzo stamp her leg for di music industry afta she gbab three Grammy Awards wey include one for SOlo Performance of di sleeper hit, Truth Hurts.
Recently she don add one more Grammy for Record of di Year for di song 'About Damn Time' wey she drop for 2022.
To add for her ogbonmge career, di classically trained flutist bin carry one 200 year old crystal flute wey fromer US president James Madison own, dey play as she dey twerk.
Dis flute na from America's fourth president wey join hand to ratify di constitution and tori be say pipo neva hear dem play di flut in recent times.
Lizzo body positivity journey
But no be today her fight for body positivity don start. Before she blow for 2015, she bin drop ablum wey she call "Big GRRRL Small World".
She also mention am for her 2015 single, My Skin wey bin sing di lyrics, "Real world, big girl meets world"
She also sing about her size for several sonfs from BGSW to Naked to her 2021 hit featuring Cardi B wey she call Runours.
E don also inform di kain interview wey she dey run.
For 2020, she celebrate herself as di "first big black woman" wey go dey di cover of Vogue Magazine.
She use di opportunity to discuss di bodi positivity movement wey although she say dey commercialized as she hala say, "girls wey get back fat, girls wey dia belle det hand, girls wey get stretch marks... na dem need to dey benefit from di body positivity now."
She say at dis time e go dey laxt for am "to just say I dey bodi positive, I go liek be body-normative. I wan normalize my bodi. Make e no be like 'oh see dis cool moemnet. Being fat dey bodi positive.'"
"No to dey fat dey normal. I tink now, I owe am to pipo wey start am to not just stop her. We gatz make pipo dey uncomfortable again so we fit change."
Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of Instagram post
Dat na why for December of dat year, wen Lizzo comot for social media dey run 10 days smoothie diet, pipo start to dey hala about wia she dey with bodi positivity.
Lizzo later comot to say, "normally I go dey fear and shame to post tins like dis online but I feel as big girl, pipo go tink say if you dey do something for health, you dey do so, so you go fit lose weight sharparly and no be wetin dey happun".
"Honestly, November stress me wella, I drink plenti, I chop spicy tins well-well and oda tins wey deal with my belle and I bin wan reverse am go as I be before."
She say di diet help her sleep, her skin and her inner peace plus including her mental stability.
She tok for di video caption say, "I dey proud of di results of my smoothie detox like I be for di belly curves and swerves."
Lizzo don also promote say she be vegan for 2020 wey she dey promot for her social media with titles like "Wetin I dey chop in a day. Tori form fat vegan."
She tell tori pipo say no be say she wan lose weight say, "I no be vegan to lose weight, I just feel beta wen I chop plants."
And truth be told, she neva reduce in size or di size of her message and performances dem.












