Aeroplane crash for Ikeja area of Lagos

Wia dis foto come from, NEMA
Authorities don confam to BBC Pidgin say one aircraft don crash for Ikeja area of Lagos for Nigeria.
According to di National Emergency Management Agency, Nema, di aircraft with registration number 5NCCQ na of Airfirst Hospitality and Tour Ltd.
Dem say e crash near di Lagos Airport.
"Following di incident, NEMA, LASEMA, Fire Service, security Agencies and oda stakeholders carried out search and rescue operation. Two crew members and two passengers don dey rescued from di remains." Nema tok.
For di pictures and video wey dey circulate ontop social media, pipo gada around di remains of di helicopter while fire fighters dey quench di fire.
Pictures from di scene show say di aircraft crash in front of AP Filling Station, and United Bank For Africa, Oba Akran, Ikeja.
E never still clear how many pipo dey inside di aircraft but Nema, say dem rescue four from di aircraft wen im crash, while di Lagos state Emergency Management Agency, Lasema - di state emergency agency tok say na two pipo dem rescue from di airplane crash wey happpun for di area on Tuesday.
Lasema reveal say di agency respond swiftly to di emergency wen im hapun around 4:00 pm and dem complete operation for 5:30 pm.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di agency tok say dem don commot di airplane wey crash for road, as im dey block di easy flow of vehicular movement.
Di emergency responders don carry di scrap of di plane inside truck for further investigation.

Wia dis foto come from, NEMA
For 2020, anoda helicopter crash - Quorum aviation for inside Opebi, for di same Ikeja wia dis one happun for Lagos kill everibodi wey bin dey on board di aircraft.
Di helicopter crash for inside one residential building inside Opebi.
Eyewitness wey bin follow BBC Pidgin tok say dem see di helicopter dey struggle to balance for air before e land ontop di fence wey separate two buildings.
National Emergency Management Agency (NEMA) Lagos territorial office acting coordinator, Ibrahim Farinloye tell BBC Pidgin say di helicoper bin dey come in from Port Harcourt, Rivers state capital wit two crew members and one passenger.
Farinloye say di accident happun as di helicopter dey return from training for Port Harcourt.
Di privately operated helicopter bin cari three pipo; two na im di crash kill on impact while di third pesin dem bin rush am go intensive care for di Lagos State University Teaching hospital before e later die.

Wia dis foto come from, NEMA












