Helicopter crash in Opebi Lagos: Today Quorum aviation accident inside building for Salvation road Ikeja kill evribodi on board, aircraft black box reveal - Eyewitness narrate shock of wetin happun

Wia dis foto come from, Other
Quorum aviation helicopter crash inside Opebi Lagos kill everibodi wey bin dey on board di aircraft.
Meanwhile Accident Investigation Bureau (AIB) don recover di black box of di Bell 206 helicopter, wit registration number 5N BQW wey belong to Quorum Aviation, one air transportation and logistics company wey dey operate for Nigeria.
Di AIB officials wey deploy to Salvation road, Opebi, wia di accident happun, recover di device around 3pm on Friday.
Di helicopter crash for one residential building inside Opebi, Ikeja Lagos happun on Friday afternoon for Nigeria commercial capital.

Wia dis foto come from, Ibrahim Farinloye/NEMA
Eyewitness wey follow BBC Pidgin tok say dem see di helicopter dey struggle to balance for air before e land ontop di fence wey separate two buildings.
National Emergency Management Agency (NEMA) Lagos territorial office acting coordinator, Ibrahim Farinloye tell BBC Pidgin say di helicoper bin dey come in from Port Harcourt, Rivers state capital wit two crew members and one passenger.
Farinloye say di accident happun as di helicopter dey return from training for Port Harcourt.

Tunji Oketunbi, general manager, public affairs of di AIB, say dem don begin investigate how di accident happun, according to wetin BBC Pidgin find out..
End of Di one wey oda users dey read well well
Officials of di Lagos State Emergency Management Agency (LASEMA), wey dey for di scene of di accident for rescue, don dey move di wreckage away.



Lagos State Emergency Management Agency, Lasema tell BBC Pidgin say dem don activate dia resources to di helicopter crash wey happun for 16A Salvation Opebi Road, today, Friday, 28th August, 2020.
NEMA tell BBC say di owners of di building wia di helicopter crash happun don get access back to dia property and dem go give dem trauma and psycho-social support sake of wetin happun on Friday.

Wia dis foto come from, LASG

Wia dis foto come from, LASEMA
Opebi crash eyewitness
One eye witness post for tweet say pesin die inside di crash wey happun right in front of im office.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
BBC Pidgin find out say di helicopter crash happun around 12:30pm on Friday.
One elderly woman, wey dey live for one of di buildings wia di helicopter crash happun, say she bin dey read her bible for inside di room wen she hear di loud noise of di crash.
"I no fit put myself togeda, I see smoke everywia and di lightning but di light dey on, na im I call my daughter to come check wetin dey happun", she tok

Na wen I comot to see wetin dey happun I see say na helicopter crash between one house and my daughter-in-law flat.
Di woman say di helicopter crash bin affect two cars for di compound.

Di privately operated helicopter bin dey cari three pipo; two na im di crash kill on impact whilst di third pesin dem be rush go intensive care for di Lagos State University Teaching hospital before e later die.


Wia dis foto come from, OTHER
Director General of di Lagos State Emergency Management Agency say dem be receive distress calls from di helicopter pilot before di aircraft crash earlier on Friday.
Lagos state goment tok tok pesin say dem don cari di deadi bodi of di dead pipo go keep for mortuary.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2
Lasema rescue workers dey on ground and dem still dey deal wit di incident.
One man wey say im name na Oladokun, wey dey come di area well-well tell BBC Pidgin say di plumber wey im send to come work for di house tell am say im see di helicopter dey shake for up like e no balance as e dey come down.
He tok say; "E say e be like say di pilot no wan land on any of di building as e dey try fall in between di two buildings make e for no wunjure pipo."

Im tok say di pilot try to land for open space n aim make am land ontop di fence wey dey between di two buildings.
See more fotos from di helicopter crash in Lagos


Wia dis foto come from, LASEMA

Wia dis foto come from, LASEMA

Wia dis foto come from, LASG




Wia dis foto come from, LASG
BBC Pidgin waka enta live from di scene wia di helicopter crash happun for Lagos.
Content is not available
View content on FacebookDe external site no concern BBC.End of Facebook post
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 3
Wia di helicopter crash in Opebi Lagos happun
Opebi na highly residential area for Ikeja di capital of Lagos State even though e get plenty businesses wey open along di major Opebi road.
Opebi na small, serene and somehow quiet environment sake of di category of middle class pipo wey dey live for di area.
Most of di residents and pipo wey get properties for Opebi na former civil servants and retired politicians sake of di closeness to di Lago State Civil service offices.
Di distance between Opebi Link Road to di Murtala Muhammed International Airport na about 9 Km by road.
We still dey chook eye inside dis tori, make you refresh dis page for more updates.













