International flight resumption Nigeria: Sirika Hadi list rules wey passengers must follow afta lockdown date of 29 August

Wia dis foto come from, NCAA
Nigeria goment announce say international flight for di kontri go resume on 29, August 2020 but wit conditions for passengers.
Di decision to reopen international airports to begin operate, afta ova fives months of coronavirus lockdown order, dey come as goment review plans to open di economy.
Even as goment dey give chances for tins to come to normal as cases of coronavirus for di kontri still dey increase, e get rules wey dem don put in place to curb di spread of di virus.

See di conditions for passengers to fly
Di Minister of Aviation, Hadi Sirika say passengers must do COVID-19 test from anywhere dem dey come from before departure dates.
Afta dat one, Oga Sirika tok say dem go create portal for passengers to pay for anoda COVID-19 test eight days afta dem land for Nigeria.
Passengers go also fill some health questionnaires online, print am and hand di questionnaires over to authority as dem dey enta di West African kontri.

Dis questionnaires go replace di forms wey dem go fill inside di plane or on arrival.
Oga Sirika also say make passengers note say oda non pharmaceutical measures like physical social distancing, wearing of nose masks, washing of hands, and temperature checks go dey in place.
End of Di one wey oda users dey read well well














