R Kelly in prison: American singer Robert Sylvester Kelly suffer 'attack inside jail', im lawyer tok

Wia dis foto come from, Getty Images
- Author, Mark Savage
- Role, BBC music reporter
R. Kelly lawyer want make di American singer immediately come out from from jail.
Na afta report say di R&B singer chop attack from anoda inmate.
Robert Sylvester Kelly lawyer Steve Greenberg tok say im customer suffer attack for Chicago Metropolitan Correctional Centre, wia Kelly dey on awaiting trial ontop sex abuse charges.
Di extent of di injuries no dey known, Mr Greenberg tok for Twitter.
Kelly don plead not guilty to multiple charges including abuse of small pikins alias minors and sex trafficking.
Tori of di alleged assault first land for TMZ, wey tok say one fellow prison inmate start to dey "punch" Kelly while im dey sit on im bed.
Di inmate be like say e dey vex alias angry sake of say di prison govnor stop dey visit di centre, pass one time, sake of di number of Kelly's fans wey dey protest outside di facility.
"My understanding be say, every time we get pipo wey dey support pro-R. Kelly dey protest outside di jail, dem dey lock down di whole facility," Oga Greenberg tok.
End of Di one wey oda users dey read well well
Kelly, wey be one of di biggest R&B stars of di 1990s, don dey prison for more dan one year as im dey await trial, wit cases wey dem file against am for Illinois, Minnesota and New York.
Dem don deny am bail three times, as one judge for Brooklyn dey tok say "strong possibility dey say dem don tamper wit witness" for case wia dem accuse am say im dey recruit women and girls to have sex wit am.

Wia dis foto come from, Getty Images
Di trial suppose start next month, but Kelly lawyer don ask make dem release am in di meantime to protect im safety.
"Di goment no fit vow for im safety, and dem no fit give am date for court," Oga Greenberg write for Twitter. "We no suppose jail pipo for long time because we no fit provide them wit due process."
One tok-tok pesin spokesman for di Federal Bureau of Prisons no fit confam or deny whether Kelly bin suffer attack.
Mr Greenberg say im don " receive different reports as to how dem wunjure am" and di "prison neva give am any informate".
"We dey hope say im no get serious injuries," he add am.











