Chadwick Aaron Boseman dead: Colon cancer cut 'Black Panther' hero King T'Challa #WakandaForever journey - See Chadwick 43 years life and times

Wia dis foto come from, Getty Images
Chadwick Aaron Boseman death still dey shock many pipo afta news break say di 'Wakanda Forever her' wey dey popular for im role as King T'Challa inside Black Panther die of cancer for di age of 43.
Doctors bin diagnose Boseman with stage three colon cancer four years ago( 2016) but e no eva make dis information public and continue to work on major Hollywood films during im battle with di deadly disease.
Dis na part of di reason why di news of im death shock di world well-well.

Wia dis foto come from, Getty Images
Im family reveal say many of Boseman films, including Black Panther, Marshall, Da 5 Bloods, and August Wilson's Ma Rainey's Black Bottom, dem film am 'during and between countless surgeries and chemotherapy.'
Before im death, fans bin dey raise concerns about im health dis year afta dem notice say im dey loss weight but Boseman no tok anything about im diagnosis,
Life and Times of Chadwick Boseman

Dem born Chadwick Boseman for South Carolina, e graduate from Howard University and get small roles for television before im first star turn in for 2013.
Di actor dey known for playing real-life figures, including professional baseball player Jackie Robinson, Supreme Court Justice Thurgood Marshall and James Brown.

Wia dis foto come from, Getty Images
Boseman wey make im film debut 12 years ago become popular wen e act as baseball icon Jackie Robinson for 2013 movie titled 42, and soul singer James Brown for 2014 movie titled Get on Up.
End of Di one wey oda users dey read well well
But na di ogbonge Black Panther 2018 blockbuster movie pipo take dey remember am well-well. For dis film na im be King T'Challa, di ruler of Wakanda- one African nation wey get di most advanced technology on earth.

Wia dis foto come from, Getty Images
Last year, Boseman tok say Black Panther don change wetin e means to be "young, gifted and black".
Oda movies wey im don act na 2016' Captain America: Civil War , "Marshall" (2017) and "Da 5 Bloods," wey Netflix release for June.

Wia dis foto come from, Disney
E also appear for 2019 film wey dem titled 21 Bridges, one action thriller wey Brian Kirk direct
Boseman leave behind im wife Taylor Simone Ledward and parent and e no born any pikin, im publicist tok.














