Chadwick Boseman wife: Late Black Panther actor marry Taylor Simone Ledward

Wia dis foto come from, Getty Images
Late Black Panther star Chadwick Boseman, secretly marry im wife Taylor Simone Ledward as im about to lose im battle for cancer.
Chadwick engage im girlfriend Taylor for October 2019 den later marry am for private ceremony.
Di first time wey pipo see dem togeda na for 2015, but for March 2019 during di 50th NAACP Image Awards im first tok say im dey date Taylor Simone Ledward.
For inside statement wey Chadwick Boseman handle put out to announce im death, di actor die for im Los Angeles home wit e wife and family by im side.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post

Wia dis foto come from, Getty Images
Who she be?
Taylor na singer wey graduate from California State Polytechnic University with degree for Music Industry Studies for 2014.
During di time wey she dey school she be di lead singer for di school Jazz band.
According to tori, she bin also audition for X Factor.
Di couple no born any pikin togeda, although Taylor sister say di two "go born some beautiful babies."
End of Di one wey oda users dey read well well













