BBNaija: Erica blast Kiddwaya about dia relationship inside Big Brother Naija house

Wia dis foto come from, @BBNaija Twitter
Fans dey react afta Erica of Big Brother Naija blast kiddwaya on Friday night about dia relationship inside di house.
Many of dem dey wonder if di "Kiddricca ship" as dia fans dey call dem don crash sake of wetin Erica tok.
She tell her fellow housemates Prince and Trikytee plus Kidd say "she don tire for all di sex talk,"
She add say: "She deserves more than wetin Kidd dey prepared to give her, im be brat and I no dey interested anymore,".
Dis her tok dey come afta di housemates bin finish to play dia truth and dare game wia some of dem drink alcohol.
Na since afta di first week inside di house wey Erica and Kiddwaya ship start to sail wen im fellow housemates dare am to kiss any girl for 30 seconds.
Di 27 year old from Benue state no waste time to to let pipo know wia im heart dey.
Im waka straight go meet Erica and di two of dem share dia first kiss for di reality television show.
End of Di one wey oda users dey read well well
See wetin Kiddwaya tok?
Kiddwaya tell Prince say im really care about Erica and im no wan hurt her.
Im say "him no fit make Erica happy because im life no dey built like that. He tok about im papa say im no dey wired to dey show emotions."
How fans react to Kiddricca breakup?

Wia dis foto come from, BBNAIJA TWITTER
Erica and kidd relationship palava na im full pipo mouth for social media see some of dia comments here
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1

End of X post, 2

End of X post, 3
Who be Erica?
Ngozi Nlewedim na 26 years old actress and commercial model from London, England. She study screen acting for di Met Film School inside London.
She say she dey passionate to be big time celebrity and like to get drunk and dance in front of di mirror alone.