'Ready to pay more' - Authorities warn of flight price hike sake of increase in cost of Jet A1 fuel

Wia dis foto come from, AIRPEACE/INSTAGRAM
Airline operators for Nigeria don threaten to shutdown for seven days if govment no do anytin about di fuel price wey dey increase.
Dem say dem no go fit fly again for di next seven days sake of di three hundred percent price increase for Aeroplane fuel.
Jet A1 wey be di name for di petrol wey aeroplane dey use increase from Nine hundred naira per litre to Three thousand, three hundred naira per litre.
Di Airline Operators of Nigeria (AON) say di price dey too much and e go worry di aviation sector well- well.
Oga Festus Keyamo wey be di Minister of Aviation and Aerospace development for Nigeria tok say even though dem go chook mouth and eye to see wetin dem fit do about di mata, di price go still increase.
Di airline operators para as dem tok say if noting hapun between di next three days, dem go shutdown.
But di Major Energy Marketers Association of Nigeria say di allegation say dem dey increase price anyhow no be true, dem add say na market realities dey dictate di price and so way crude oil prices dey rise and fall, foreign exchange wey no stable and logistics cost add to di price increase kasala.
Na since last week wey di AON bin raise alarm as dem bin dey hala about dis price hike wey change since 28 February, 2026.
End of Di one wey oda users dey read well well
No be for only Nigeria dis pricing mata dey hapun as airlines for UK dey cancel flights too sake of di price wey dey increase, some dey tell passengers to pay extra money while some still dey manage.
Wetin dey cause di price hike?
All dis dey hapun sake of di war for di Middle East, sake of say most of di jet fuel wey dey supply di world dey pass through di Strait of Hormuz wey don close since March 2026.
And di impact no be just for Nigeria.
Some airlines dey also cut back di number of flights dem dey operate, wey fit mean say travellers dey face changes to dia plans.
For UK, even though airlines no dey short of fuel physically, dem dey propose say dem no go get any fuel to work wit during summer if di kasala between US, Israel, Iran and Lebanon continue.
Some airlines wey dey cut down flights include:
KLM, Air Canada, Asiana Airlines, Delta Airlines, Lufthansa, SAS.
Meanwhile, British Airways owner IAG, EasyJet and Jet2Holidays say dem go continue wit dia regular flights.
Some airlines even tok say dem go begin charge pipo wey carry luggage or di passengers go pay more money.
Di flights na Air France-KLM, Indigo, Pakistan International Airlines, Thai Airways, Turkish Airlines-Sun Express, Virgin Atlantic.














