Kaycee Madu biography: Canada Minister of Justice and Attorney General of Alberta Province na first African Igbo pesin to land dis job

Wia dis foto come from, KAYCEE MADU/FACEBOOK
One Nigerian-born Canadian Kelechi Madu alias Kaycee Madu don become di Minister of Justice and Solicitor General of Alberta, one province for Canada.
Dem born di 47 year old for Nigeria and e grow up for South West Nigeria. He graduate from di University of Lagos wit Law Degree for 2001. He practice law for Nigeria and Alberta.
According to CBC News, Kaycee and im wife relocate go Canada for 2005.
Wit dis new position, e replace Doug Schweitzer, di new minister of jobs, economy and innovation.
Kelechi Madu Career as e waka:

Wia dis foto come from, KAYCEE MADU/TWITTER
Before dis new appointment, Oga Madu na member of di legislative assembly of di province wey dey represent di district of Edmonton-South West after e win di 2019 Alberta general election. Di ogbone position im hold until 25 August 2020 wen dem appoint am as di Minister of Justice and solicitor general of Alberta.
On 30 April 2019, dem appoint am as di Minister of Municipal Affairs for Executive Council of Alberta.
Kelechi Madu na member of di United Conservative Party, di first Nigerian wey go be cabinet member for Alberta.
For 4 March 2020, di Lieutenant Governor of Alberta through an Order-in-Council decorate Kaycee Madu as Queen Counsel, di highest honour dem fit award to any lawyer wey don make correct and ogbonge contributions to how law and order take progress for di society.
End of Di one wey oda users dey read well well
Powerful Statement from Premier of Alberta

Wia dis foto come from, KAYCEE MADU/TWITTER
Di Premier of Alberta Jason Kenney tok say di appointment of Oga Madu dey make powerful statement and e dey come at a time wen Albertans don dey more sensitive to racial issues.
He say Oga Madu na "[Madu] na man wey don experience racial prejudice firsthand and wey fit bring sensitivity to this important role," Mr Kenney tok.
Kelechi Madu speech as dem appoint am Minister of Justice and Solicitor General
For inside statement wey Kaycee Madu issue, e say di importance of carrying di new ministry forward even inside dis difficult social and economic times dey heavy for im mind.

Wia dis foto come from, KAYCEE MADU/FACEBOOK
Di new Minister for Justice and Solicitor General as he accept di new role say im dey determined to make sure di justice system represent all Albertans in a way wey dey fair and accountable.
He say di way im reason how to apply justice and equality go always reflect who im be as papa, husband, citizen, lawyer, and politician.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
Plenty ogbonge pipo and organizations don enta social media to congratulate di first African born provincial Minister for Canadian history and also di Provincial Secretary and Keeper of di Great Seal of the Province of Alberta, part of dem na di Nigeria President Muhamamadu Buhari, he describe di honour as "landmark and historic," Oga Buhari say once again people of Nigerian descent na go-getters, wey dey always excel anywhere dey go for life.

Wia dis foto come from, KAYCEE MADU/FACEBOOK
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2

End of X post, 3

End of X post, 4

End of X post, 5

End of X post, 6