Mary Robinson go lead AfDB probe into Akinwunmi Adesina 'parapo' for Africa Development Bank

Wia dis foto come from, Getty Images
Ireland former President Mary Robinson go lead panel wey go probe Akinwumi Adesina, di Nigerian leader of di Africa Development Bank (AfDB).
Di panel go chook eye for di report wey di AfDB ethics committee do, wey clear oga Adesina of moni mago-mago accuse for May.
But, US dey mount serious pressure make dem do independent investigate, as dem reject di first one wey bin clear am of di accuse.
One 15-page report bin accuse am say, im administration no perform well, im corner moni for imsef, plus godfatherism. Oga Adesina say di accuse na lie.
Madam Rodinson go head di probe wit Gambia Chief Justice Hassan Jallow and World Bank integrity vice president Loenard McCarthy, na so di bank board of govnors tok for statement on Wednesday.
Di panel go delivery dia report between two to fur weeks.
Early for June, Board of Governors office for African Development Bank don march break from any fresh investigation of di bank Presido, Dr Akinwunmi Adesina- wey be Nigerian.
Dis dey come as di continent bank put leg stand gidigba behind Adesina afta accuse say him dey give appointments and contracts for di bank to im padi and family members.
End of Di one wey oda users dey read well well












