Akinwumi Adesina win re-election as AFDB president

Akinwumi Adesina

Wia dis foto come from, AFP

Akinwunmi Adesina don win im re-election bid as presido of di African Development Bank.

E go head di bank for di next five years afta dem clear am of corruption for one investigate for im first tenure.

Oga Adesina na di only candidate for di election wey hold online for dia virtual meeting on Monday.

Di panel im face wey former Irish president Mary Robinson lead clear Mr Adesina of all charges wey di whistleblowers nack ontop im head, di agency quote say one report tok.

Mr Adesina bin dey face accuse of poor governance, say im dey kolobi money and do favouritism. Accuse wey im bin don deny.

Di panel of three experts, wey Ms Robinson lead alongside Gambia Chief Justice Hassan Jallow and di World Bank integrity vice president Leonard McCarthy clear am of wrongdoing.

Di agency quote one report wey say Mr Adesina dey cleared of all charges wey some employees wey dem no name accuse am.

One internal investigation bin don clear am of di allegations, but US Treasury Secretary Steve Mnuchin personally sign one letter to di board say e reject di outcome.

Di US na one of di 27 non-regional members of di AfDB and na di second largest shareholder.

"Di panel agree with di committee for dia findings in respect of all di allegations against di president and find say dem consider dem well-well and di committee dismiss dem," AFP bin quote di report.