Pope Leo XIV hold giant mass for Cameroon, plus oda highlights of im visit to di kontri

Pope Leo XIV wear white robe raise im hand dey pray for woman wey carry her pikin for leg. Oda pipo dey di background

Wia dis foto come from, Reuters

Read am in 7 mins

Pope Leo XIV don end in official visit to Cameroon as e comot from di West African kontri on Saturday afternoon.

Di Pope wey spend three days for Cameroon enta plane dey go Angola to continue di third part of im apostolic visit.

According to di Vatican News, na around 12:45 local time di flight wey di Pope dey inside takeoff from Yaoundé-Nsimalen International Airport.

For di farewell ceremony wey hapun for di Cameroonian airport, Pope Leo bin dey togeda wit di Prime Minister of Cameroon, Joseph Dion Ngute, im listen to di national anthems as di guards of honor line up as im waka ontop red carpet bifor e enta di aeroplane.

Pope Leo XIV stand inside im vehicle as e dey wave im hand dey greet pipo

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, E end im visit to Cameroon wit ogbonge mass on Friday wey ova 200,000 pipo attend according to di Vatican.

E end im visit to Cameroon wit ogbonge mass on Friday wey ova 200,000 pipo attend according to di Vatican.

Di open-air Mass, na di biggest crowd wey di Pope don gada during im 11-day Africa tour.

For di economic city of Douala on Friday, di Pope continue im message of peace afta e visit di region for Cameroon wey dey speak English. Di region dey suffer from ova ten years of rebellion.

Im later warn about di dangers of artificial intelligence (AI), wey im tok say dey lead to di spread of "polarisation, kasala , fear and violence".

Crowd of pipo welcome di Pope as im bin land for di Japoma Stadium.

Im stand inside im vehicle - Popemobile - as e wave to di crowd.

Di Pope message on Friday focus on spiritual mata as e encourage young pipo to diversify dia talents and support dia communities.

"Reject evri form of abuse or violence, wey dey deceive by promising easy gains but harden di heart and make am insensitive," im tok.

"Do let yoursef dey corrupted by temptation wey dey waste your energies and no dey serve di progress of society."

Leo go from Cameroon next travel go Angola and Equatorial Guinea. E dey use dis im tour to call for peace and reconciliation.

Dis na highlights of Pope Leo XIV journey to Bamenda

Women hold di foto of di Pope

Wia dis foto come from, Michel Mvondo / BBC

Wetin we call dis foto, Joyful crowds bin turn out to welcome di Pope as e deliver im message of peace to areas wey separatist insurgency don scata

Pope blast foreigners wey dey exploit Africa

Catholic faithful comeout for mass wit di pope

Wia dis foto come from, Reuters

During im 3-day visit to one conflict-hit region of Cameroon, Pope Leo XIV bin lambast foreigners wey dey exploit di wealth of Africa for profit .

For inside one of im plenty comments wey e make for di Central African kontri, e blast dos wey dey spend billions on wars and e tell Cameroon govment to root out corruption for peace to prevail.

E bin spend time for Bamenda, one city wey dey di centre of Cameroon brutal and long-running separatist rebellion.

Na outsiders dey put fire for internal problems "in di name of profit, to continue to dey exploit and plunder di African continent", e tell one estimated 20,000 worshippers during one Mass for Bamenda Airport.

"Na one handful of tyrants dey dabaru di world," e tell di pipo wey gada - im comments bin come afta US President Donald Trump recent criticism of di pontiff, wey become di first US-born Pope last year.

"Dos wey dey rob your land of dia resources dey generally invest most of di profit for inside weapons, and dem dey continue to carry endless cycle of destabilisation and death," di 70-year-old Pope tok.

Pope meet wit religious leaders and victims of di Anglophone conflict

Pipo sidon outside to discuss di crisis for di North-West and South-West regions

Wia dis foto come from, Michel Mvondo / BBC

Wetin we call dis foto, Pipo sidon outside to discuss di crisis for di North-West and South-West regions

For one peace meeting for Bamenda wey hold for Saint Joseph Cathedral, religious leaders and victims of di Anglophone conflict bin take turns to share di impact of di fight-fight wey dey hapun for di kontri wit di Pope.

Di about 10-year insurgency for Cameroon two English-speaking regions don leave at least 6,000 pipo dead and many more dey forced to run comot dia homes.

One Muslim leader tok how dem dey kill members of di Mbororo indigenous community, and dem dey loot dia cattle plus oda items.

One reverend sister share details of how separatist fighters kidnap her as she highlight di seriousness of di conflict.

Anoda man tok how e dey force forced to leave im house.

Di Pope hail dia work and say na model for di whole world: "Make we thank God say dis crisis no degenerate to religious war."

Commentators say di Pope dey unusually blunt for im speeches for Cameroon.

Na since 2017, dos wey wan create breakaway state for Cameroon Anglophone region don dey fight govment forces.

Dem dey para sake of wetin dem see as di marginalisation of Cameroon English-speaking minority by di Francophone-dominated govment.

Pope meet wit Cameroon President Paul Biya

Pope Leo and Paul Biya hold hands

Wia dis foto come from, EPA/Shutterstock

Wetin we call dis foto, Paul Biya, di world oldest head of state, greet Pope Leo for Yaoundé bifor di pontiff move to Bamenda

Pope Leo on Wednesday bin meet wit President Paul Biya for di presidential palace for di capital, Yaoundé, wia e give pointed advice to di govment.

"In order for peace and justice to prevail, di chains of corruption - wey dey disfigure authority and strip it of dia credibility - must dey broken," e tok.

"Hearts must dey set free from an idolatrous thirst for profit," di pontiff tok as di world oldest head of state just sidon dey look witout emotion.

During di same address, Pope Leo urge Cameroonian authorities to integrate di voices of women, youth, and di civil society in decision-making processes, underscoring dia vital role in nation building.

Di pontiff describe young pipo as di hope of Cameroon and di Church.

"Dia energy and creativity dey invaluable. Investing in dia education, training, and entrepreneurship dey essential for peace and for preventing di loss of talent and di spread of social ills," e tok.

Pope Leo bin also address di kontri worrying security situation wey don claim lives, disrupt schooling, and displace families. E re-echo im previous message against wars, as e say, "make peace no dey reduced to slogan."

Additionally, e caution against corruption, lack of transparency, and call for respect for human rights.

Afta di meeting for di Presidential Palace, di Holy Father visit one orphanage and later meet wit Bishops.

Pope Leo hold giant mass for Douala

Pope Leo urge Cameroonian youth to shun abuse and violence, as e encourage dem to diversify their talents and support dia communities.

For one mass, wey tens of thousands attend for di economic capital Douala, Pope Leo bin focus im message more on spiritual matters pass social-political criticism wey mark di early days of im visit to di Central African nation.

However, e note di contrast for di lives of Cameroonians wey e say dey blessed wit natural resources but dey drowned in material and spiritual poverty.

"Reject every form of abuse or violence, wey dey deceive by promising easy gains but dey harden di heart and make am insensitive," di pontiff tell young pipo.

Ahead of Friday grand mass, several pipo bin spend di night outside di Japoma stadium premises to participate for di papal ceremony.

Peace na di main theme of di Pope 11-day tour of di continent, wit Angola and Equatorial Guinea next on im agenda.

E start im trip for Algeria on Monday, wey mark di first time any pope go visit di predominantly Muslim kontri.

During im two days for Algeria, e bin go di Great Mosque for Algiers.

"I tink di visit to di mosque dey significant and to say dat although we get different beliefs, we get different ways of worshiping, we get different ways of living, we fit live together in peace," e tok afterwards.