NLC strike update: Protesters break gate enta National Assembly- How workers protest go for Lagos, Kano, Port Harcourt, Abuja and oda states for Nigeria

NLC protest

Workers across Nigeria on Wednesday carry waka enta all di streets to protest wetin dem call ''anti-masses policies'' of di Tinubu-led goment.

Part of dia complains na di wahala wey kontri pipo dey face sake of di fuel subsidy removal by President Bola Tinubu.

Although, Tinubu don share im plans to alleviate di hardship, di Labour Unions say e no dey enough.

Di unions say Tinubu speech no be di ''silver bullet'' wey Nigerians dey expect.

'Give us one week grace' - Senate

Nigeria senate don ask di protesting workers make dem give dem one week to chook eye for di issues wey dem raise.

Nigeria Senate Chief Whip, Ali Ndume wey address workers say make workers give dem small time to discuss wit di leaders of di union on how to settle dia demands.

"Make una beat us but make una no kill us make una slap us but make una no shoot us, we promise una to give us one week and if afta di one week nothing happun, una fit go on strike.

"Dis una letter, I go present am to di Senate and we go start to negotiates sharp sharp.'' Ndume tok.

From di nation capital, Abuja, to di commercial hub, Lagos, Kano, Abia, Rivers and oda states, hundreds of workers under di Nigeria Labour Congress (NLC) and Trade Union Congress (TUC) carry placard wit different label to show say dem no dey happy wit goment.

Abuja

NLC protest

Workers for Abuja, Nigeria capital break di gate of National Assembly to get access into di Parliament.

Security agents bin lock di gate to stop di protesters from entering but dem no gree.

Dis na as di Nigeria Labour Congress, NLC and Trade Union Congress, TUC dey protest removal of fuel subsidy for di kontri.

NLC president, Joe Ajaero lead hundreds of protesters from Unity Fountain to Federal Ministry of Justice den National Assembly as dia final destination.

Lagos

NLC protest

For Lagos wia di protest dey go on, di labour unions begin waka from Ikeja go the government office as dem dey sing different song.

Di leaders of di protest bin tok say dis first dey na still warning and if dem no get any reply from goment, dem go continue dey occupy di streets.

Some of di protesters for Lagos carry placards as dem also wear clothes wey represent dia unions. Traffic no move as di protesters don block di road sotey pipo wey dey go work park dia cars begin dey look and hail di protesters.

Di police and oda security agencies dey ground to dey try control di pipo and traffic join as di protest dey go on.

Rivers

NLC protest

For Port Harcourt di Rivers State capital, di protesters move from Labour House through Ikwerre Road to di Rivers State Goment House wia dem go lay dia demands before di Rivers state govnor to transmit to President Tinubu.

NLC Chairman for di state Alex Agwanwa say dia demands among oda things na di repair and full functioning of all di refineries for Nigeria and increase in di minimum wage of workers for Nigeria.

Kano

NLC protest

Protesters from organiser labour and some private individuals gather for front of goment house Kano as part of today protest.

Secretary to di state goment Baffa Bichi na im comot to receive the protesters and tok say dia goment go do dia best to helep pipo.

NLC boss for Kano Comrade Kabiru Inuwa tok say dem comot to show goment say dem no dey happy with di suffer wey poor pipo dey suffer now due to goment policies.

Dr Bichi also tell di protesters say di govnor Abba Kabir Yusuf no fit comot to meet dem as today na Wednesday wey be State Executive Council day.

But e assure dem say di govnor go receive dia message and go try deliver am to presido Bola Tinubu.

Immediately after NLC chairmo Comrade Inuwa tell everybody to return home or im place of work as di event don finish around 10:10 am.

"Today no be strike na just protest and we don submit our concern to goment so i dey ask everybody to either return home or place of work."

Ebonyi

NLC protest

For Ebonyi state, di chairman of NLC Ogugua Egwu and im TUC counterpart, Chidi Igboji lead protesters in dia numbers round di city of Abakaliki.

Like dia colleagues for oda states, dem carry placard and banners of various sizes with different inscriptions.

Dem bin gada for di Pa Ngele Oruta Township Stadium Abakaliki early mor-mor.

Wetin NLC dey demand for?

NLC say dem want goment to implement di resolutions wit congress jointly signed wit dem and Trade Union Congress.

Dem want immediate reversal of all "anti-pipo policies of goment" including di recent hike in petrol price, school fees and VAT.

NLC want goment to fix local refineries for Port Harcourt, Warri and Kaduna.

Dem want goment to release eight months withheld salaries of university lecturers and workers.

Dem also want appropriate recognition and support to di Presidential Steering Committee and di work of dia sub committees.

NLC say dem want "goment to end dia inhuman actions and policies".

Since NLC don decide to go on wit di strike despite calls from different quarters to cancel am, di Nigeria Police Force (NPF) don promise to ensure say room no go dey for any violent protest as dem promise to provide security.

Di tok-tok pesin for di police Muyiwa Adejobi say di police dey committed to ensure di safety and of all citizens during di period of di protest.

"Di IGP urge all parties wey dey involve to ensure say dem conduct di planned demonstration in a peaceful manner so jaguda pipo no go hijack am," Adejobi tok.

Adejobi add say di police go meet any attempt by jaguda pipo to exploit di situation for violence wit firm professional and lawful approach.

"Di police no go tolerate any act wey threaten di peace and wellbeing of our kontri," e tok.

Wetin be Tinubu plan

For im nationwide address on Monday, President Tinubu as im understand say di kontri dey suffer sake of di policies way e make.

E reveal say plans don dey underway to reduce di burden on di pipo.

Di Nigeria leader among oda things highlight di following as part of di plans to reduce di burden on di pipo:

  • Salary review- E say im dey work wit labour unions to introduce a new national minimum wage for workers."Once we agree on a new minimum wage and general upward review, we go make provision for am for immediate implementation." Di president tok.
  • Strengthen di manufacturing sector, increase dia capacity to expand and create good paying jobs. Oga Tinubu say dem go spend N75 billion between July 2023 and March 2024 to fund 75 enterprises wey get great potential to kick-start sustainable economic growth, accelerate structural transformation and improve productivity.
  • Each of di 75 manufacturing enterprises go fit access N1 billion credit at 9% per annum wit maximum of 60 months repayment for long term loans and 12 months for working capital.
  • Support micro, small and medium-sized enterprises and di informal sector wit N125bn.
  • Order di immediate release of 200,000 Metric Tonnes of grains from strategic reserves to households across di 36 states and FCT to moderate prices. Dem go provide 225,000 metric tonnes of fertilizer, seedlings and oda inputs to farmers wey dey committed to food security agenda.
  • Support expansive agricultural programme wit N200 billion out of di N500 billion wey di national assembly approve.
  • Invest N100 billion between now and March 2024 to acquire 3000 units of 20-seater CNG-fuelled buses wey go dey affordable to kontri pipo.

More foto from di nationwide protest

NLC protest

Human rights lawyer, Femi Falana and anoda popular activist, Omoyele Sowore join di nationwide protest of di Nigerian workers for Lagos state.

NLC protest

Workers for Abia state also join dia colleagues to ask for di implementation of dia demands.

NLC protest
Wetin we call dis foto, Members of di Labour Unions for Ogun state also show face for di street

For Kwara state, Deputy govnor, Kayode Alabi address di protesters

NLC protest
Wetin we call dis foto, Workers for Kwara state north-central Nigeria carry waka go govnor office
NLC protest
NLC protest