Court sentence Nigeria former minister of power Saleh Mamman go 75 years imprisonment

Wia dis foto come from, Saleh Mamman/Facebook
Federal High Court for Abuja, Nigeria, don sentence di kontri former minister of power Saleh Mamman go 75 years imprisonment sake of corruption and fraud.
Earlier for May 7, di court bin convict di former power minister on 12 count charges wey border on fraud and money laundering wey di EFCC file against am.
Justice James Omotosho for di judgement say di anti-graft agency successfully establish say di former minister dey guilty beyond reasonable doubt.
Charges against am include illegal diversion of public funds wey reach 33.8 billion naira, criminal breach of trust unto funds wey Nigerian govment release for di Mambilla and Zungeru Hydroelectric Power Project, among odas.
Di court say im go serve im sentences consecutively and must pay back di balance of 22 billion wey dey linked to di Mambilla and Zungeru power project.
Di judgement dey come few days afta Oga Mamman pick form to contest for govnorship for Taraba State ahead of di 2027 general elections under di All Progressives Congress (APC).
Mamman na di minister of power wey bin serve under late former President Muhammadu Buhari.
According to EFCC, Mamman bin dey absent for court but dem still prosecute am for money laundering to di 'tune of 33,804,830,503,73 naira ( Thirty three billion, eight hundred and four million, eight hundred and thirty thousand, five hundred and three naira, seventy three kobo).'
Wetin be di charges wey dem sentence Saleh Mamman for?
For 7 May 2026, Justice Omotosho of di Federal High Court for Abuja first convict di former Nigeria Minister of Power, Mamman.
Dem find am guilty of 12-count charge wey border on fraud and money laundering wey di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) file against am.
Di court find oga Mamman guilty of:
- Illegal diversion of public funds wey reach about ₦33.8 billion
- Criminal breach of trust in relation to funds wey di Nigerian govment release for di Mambilla and Zungeru Hydroelectric Power projects.
- Making cash payment of $655,700 (₦200 million) for one landed property for Abuja, and e no collect di money from any financial institution.
Dis article contain content wey Facebook provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Facebook cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of Facebook post
Who be Saleh Mamman?
Mamman Kwagyang Saleh take oath as Nigeria Minister of Power on 21 August 2019.
Former President Muhammadu Buhari swear in Saleh months afta e win second term election to lead di West African nation.
Dem born Mamman Saleh on 2, January 1958, according to multiple sources.
Saleh hail from Taraba State, northeast Nigeria.
For 1988, e bag Higher National Diploma in Electrical Electronics from Kaduna Polytechnic. E also hold MBA in Business Administration from Bayero University Kano, wia e graduate for 2015.
E serve as Minister of Power from August 21, 2019, to September 1, 2021, and Buhari remove am from office inside one cabinet reshuffle.










