All you need sabi as UK increase financial requirements for immigrants for 2025

Wia dis foto come from, Getty Images
United Kingdom don increase dia financial requirements for immigrants wey wan study or work for di kontri in di year 2025.
UK wey don dey try reduce di impact of immigration on dia housing and economy don make changes on dia website to reflect wetin immigrants go need show as proof of fund to study or work for di kontri.
According to UK website, immigrants wey wan enta UK on study visa afta 2 January, 2025 go need £1,483 per month to support demsefs for London and £1,136 per month outside London.
If you wan start one year master course for inside London you go need hold (£1,483× 9 months) wey go be £13,347 for cost of living and (£1,136× 9 months) wey go be £10,224 for outside London.
You gatz get dis money for at least 28 consecutive days bifor you apply for your study visa.

Wia dis foto come from, Getty Images
Bifor di new changes, students bin need £1,334 per month (for up to 9 months) for courses for London and £1,023 per month (for up to 9 months) for courses outside London.
But if you don already dey live for UK you dey exempted from di financial requirements and some kontris dey also benefit from dis exemption.
Family income threshold increase
Some key changes na di family income threshold wey don increase from £18,600 to £29,000 and e go increase to £38,700 in early 2025
Di goment dey make di changes so foreign partners no go be burden of di UK goment, so pipo go dey ready for dia spouse/partner visa. UK goment wan make pipo wey dey bring dependants to live in di kontri to dey financially capable to support dia own family.
Couple wey wan enta UK wit family visa go need extra money for dia pikin, you go need £3,800 per year for di first child and £2,400 extra for each additional pikin you wan bring wit your first pikin.
If you no get dis money you go need prove say your pikin dem na British or Irish citizens.
You fit benefit from dis exemption if your pikin dem na citizens of EU, Iceland, Liechtenstein, Norway, Switzerland and dem no get pre-settled status.
Pipo wey don already dey live for UK wit family visa wey no get di required money for each child go need prove say dia pikin don live for UK for 7 years since birth.

Wia dis foto come from, Getty Images
As for skilled workers wey be first-time applicant, dem go need to pay above £29,000 to show say dem fit support demsefs and pay accommodation for UK.
As skilled worker visa applicant, your gatz dey eligible for dis visa and work for UK employer approved by di Home Office.
You gatz get di required income for your account for 28 days bifor applying for visa.
But if you dey on employer sponsorship visa, dem go cover di cost for di first month.
Di UK goment also make some minor fees increments for visa applications such as tourist, family visas, spouse, child, study wit exemption for some specific disability or career benefits (Armed forces, health workers and talent).









