Four times Badenoch tok about Nigeria since she become Conservative Party leader

Kemi Kemi Badenoch na di leader of Conservative Party for UK

Wia dis foto come from, Getty Images

Read am in 4 mins

Kemi Badenoch don drag Nigeria several times since she become di Conservative Party leader for United Kingdom .

Many Nigerians dey table Badenoch mata about di kontri wia her papa and mama come from for social gathering, office, radio and television.

She torchlight her early years for Nigeria wia she describe growing up in fear and insecurity for kontri wey she say corruption boku.

Nigerian Vice-President Kashim Shettima don even suggest make Badenoch "remove Kemi from her name" if she no dey proud of her "nation of origin".

Badenoch leave Nigeria 28 years ago to return to United Kingdom wia dem born her.

Dis na four times wey Kemi Badenoch don drag Nigeria since she become leader of di opposition party for yonda.

'Growing up in fear'

Kemi Badenoch don tok plenty tins about Nigeria bifor but e no really clear which of her comments wey Vice President Kashim Shettima bin dey respond to wen e suggest make Badenoch "remove Kemi from her name" if she no dey proud of her "nation of origin".

Previously, she don describe growing up in fear and di insecurity for di kontri and also tok about corruption.

During im speech on migration for Nigerian capital Abuja, Shettima say im goment dey "proud" of Badenoch "in spite of her efforts to abuse her nation of origin."

Pipo clap for Shettima wen im say: "She dey entitled to her own opinions; she get evri right to remove Kemi from her name but dat no change di fact say di greatest black nation on earth na di nation called Nigeria".

"I no be PR for Nigeria"

Kemi Badenoch defend her past comments about Nigeria, afta she describe growing up in fear and insecurity for kontri wia she say corruption plenti.

Few days afta she make dat comment, Nigerian Vice-President Kashim Shettima react and say she fit "remove the Kemi from her name" if she no dey proud of her "nation of origin".

Tori pipo ask her about Shettima comments, Badenoch tok-tok pesin answer dem say she "stand by wetin she tok" and add say "I no be PR for Nigeria".

'Yoruba na my true identity'

Di head of UK Conservative Party cause anoda gbas-gbos wit di mata of her identity afta she identify herself as Yoruba and add say she no get anytin in common wit Northern Nigeria.

She tell British media dis one recently. Badenoch wash hand comot from Northern Nigeria, wey she refer to as a haven for Islamism and Boko Haram.

"I find am interesting say evribodi dey define me as a Nigerian. I dey identify less wit di kontri dan wit specific ethnicity [Yoruba]," she tok,

"I no get anytin in common wit di pipo from di north of di kontri, di Boko Haram wia Islamism dey.

"Yoruba na my true identity, and I refuse to dey lumped wit di northern pipo of Nigeria, wey 'be our ethnic enemies, ' all in di name of being called a Nigerian.

"Sombodi bin tell me bifor wen I bin dey veri young say my surname na name for pipo wey be warriors. Dem bin protect di crown, and dat na wetin I see mysef dey do.

"I dey here to protect, and I go die to protect dis kontri becos I know wetin dey outside."

'Police tiff my brother shoe'

For 12 December 2024 Kemi Badenoch share her experience wit Nigerian police for interview wit Honestly With Bari Weiss

"My experience wit di police for Nigeria dey veri negative and to come UK my first experience wit di police dey veri positive.

"You know say di police for Nigeria go rob us, so wen pipo tok say I get di experience wit police becos I black and dem bin white I bin like wetin be dat

"You know I remember di police steal my brother shoes and im watch.

"Na veri poor kontri so pipo dey do all sorts of tins and to give pipo gun na just license to intimidate - dat no be di bar wey we suppose use for British police, e suppose dey high well-well," Kemi tok.