'I no be PR for Nigeria' - Kemi Badenoch reply to criticism from Vice President Shettima

Wia dis foto come from, EPA
- Author, Sam Francis
- Role, Political reporter
- Read am in 3 mins
Kemi Badenoch don stand by her past comments about Nigeria, afta di vice-president of di kontri accuse her say she dey belittle di kontri.
Di Conservative Party leader, wey dem born for di UK but wey mostly grow up in Nigeria, don repeatedly describe say she bin grow up in fear and insecurity for di kontri wey corruption dey worry.
On Monday, Nigeria Vice-President Kashim Shettima bin suggest say Badenoch fit "remove di Kemi from her name" if she no dey proud of her "nation of origin".
Wen dem ask her about Shettima comments, Badenoch tok-tok pesin say she "stand by wetin she tok" and "no be PR for Nigeria".
"She be di leader of di opposition and she dey very proud of her leadership of di opposition in dis kontri," e tell reporters.
"She dey tell di truth. She dey tell am like e be. She no go sufri tok."
During one speech on migration for Nigerian capital Abuja, Shettima bin tok say govment dey "proud" of Badenoch "in spite of her efforts to belittle her nation of origin."
Dem clap for Shettima wen e bin tok say: "She dey entitled to her own opinions; she even get every right to remove di Kemi from her name but dat no underscore di fact say di greatest black nation on earth na di nation called Nigeria."
E bin compare Badenoch approach to dat of her predecessor, Rishi Sunak - di UK first prime minister of Indian heritage - as "one brilliant young man" wey "no eva belittle im nation of ancestry".
E no clear which comments Shettima dey refer to, but Badenoch many times don mention her Nigerian upbringing for inside speeches and interviews.
Born Olukemi Adegoke for Wimbledon in 1980, she bin grow up for Lagos, Nigeria, and in di United States wia her physiology professor mother bin dey lecture.
She den return to di UK for di age of 16 to live wit one friend of her mama sake of di worsening political and economic situation for Nigeria, and to study for her A-levels.
Afta she marry Scottish banker Hamish Badenoch, she take her husband surname.
For di Conservative Party conference dis year, Badenoch bin compare di freedoms she experience for UK to her childhood for Lagos "wia fear dey everywhere".
She describe di city as lawless, recall say she bin dey hear "neighbours scream as dem dey rob and beat dem - and dey wonder if your home go be next".
Last week during one tour of di US, she bin describe her home city as "one place wia almost everytin seem to dey broken".
Her experiences bin help shape her conservative ideals and set her against socialism, she bin tok.









