Russia arrest Uzbek man ova killing of general for Moscow

Wia dis foto come from, EPA
Russia security service tok say dem don arrest one 29-year-old man from Uzbekistan ova di killing of senior general Igor Kirillov and im assistant for Moscow.
Lt Gen Igor Kirillov, head of di Nuclear, Biological, Chemical Defence Forces (NBC), dey outside one residential block early on Tuesday wen device wey dey hide inside one scooter explode.
Di Russian security service say di unnamed suspect na recruit from Ukrainian intelligence, according to state media agencies.
Ukraine security service don already claim say na dem dey behind di killing, one source tell di BBC on Tuesday.
Di Russian Federal Security Service (FSB) tok-tok centre on Wednesday say di 29-year-old dey "suspected of committing terrorist act".
One statement say during "interrogation e explain say na di Ukrainian special services recruit am".
FSB said dem guarantee di suspect reward of $100,000 and permission to move to di European Union in exchange for killing Kirillov.
Based on Ukraine instructions, e arrive for Moscow and receive one homemade explosive device.
E place di explosive device on electric scooter, wey e park for di entrance to di residential building wia Kirillov dey live, di FSB tok.
E den rent one car to monitor Kirillov residence and also install one camera livestreaming one video feed from di site to im handlers in di Ukrainian city of Dnipro.
Wen dem see Kirillov comot from di house, di suspect detonate di bomb, di statement tok.
Lt Gen Igor Kirillov, head of the Nuclear, Biological, Chemical Defence Forces (NBC), dey comot from a residential block early on Tuesday wen one device wey dem hide under scooter explode, Russia Investigative Committee tok.
Dem add say im assistant also die.
In October, UK place sanctions on Kirillov, saying e supervise di use of chemical weapons in Ukraine and act as a "significant mouthpiece for Kremlin disinformation".
On Monday, Ukraine secret service, SBU, charge am in absentia, tok for Telegram say na im dey "responsible for di mass use of banned chemical weapons".
Di Investigative Committee, Russia main investigative authority, say dem bin "open a criminal case into di murder of two servicemen".

Pictures from di scene show di entrance to a building wey dey badly damaged, wit marks on di walls and a number of windows don blow out.
Two body bags also dey on di street.
Di committee say sabi pipo don dey work for di scene of di incident and dem dey also carry out search activities.
"Investigators, forensic experts and operational services dey work for di scene".
"Dem dey carry out investigative actions and operational search activities to establish all di circumstances of di crime."
Meanwhile, di UK don alreadi tok bifor say Kirilov dey responsible for some chemical weapons. Na part of why dem sanction am.
Di UK say Kirillov dey "responsible for helping deploy barbaric weapons", and also sanction all im troops from di Radiological, Chemical and Biological Defence.
"Kirillov na been a significant mouthpiece for Kremlin disinformation, spreading lies to cover Russia shameful and dangerous behaviour," UK say.
Di sanction mean any assets wey e get for di Uk go dey frozen, and dem ban am from coming to di UK.
Who be Igor Kirillov?

Wia dis foto come from, AP
Igor Kirillov na senior Russian general and di head of di kontri Nuclear, Biological, Chemical Defence Forces (NBC).
Dem appoint Kirillov to head di force in April 2017. According to Russian state-run media outlet Tass, e attend di Kostroma Higher Military Command School of Chemical Defence.
Di general serve in different roles for Russia military wey dey associated wit very dangerous materials, including di Directorate of di Chief of the Radiation, Chemical and Biological Defence Troops.
Ukraine Security Service (SBU) sentence Kirillov in absentia sake of say e use chemical weapons wey dey banned for Ukraine, di Kyiv Independent bin report.
Di SBU claim say Russia use chemical weapons nearly 5,000 times under Kirillov leadership.
Di UK, New Zealand, Canada, among odas bin sanction Kirillov for im role for Russia war in Ukraine.







