Dangote sustain fuel price competition wit NNPCL, slash price of petrol

Dangote Petroleum Refinery don reduce di price of dia Premium Motor Spirit (PMS) alias petrol.
Di company wey now dey in competition wit goment company, NNPCL drop di price of dia product to 899 naira 50 kobo per litre – dat na $0.58 per litre of fuel.
Di company make di announcement on Thursday, six days to Christmas.
Over di years Nigeria dey usually experience fuel scarcity during festive season for December. E no clear why dis dey usually happun. Though di situation neva occur for sometime but Nigerians dey always expect am.
Dangote for statement wey dem release say dem decide to reduce fuel price to "provide much-needed relief for Nigerians ahead of di holiday season".
Dis na di second time Dangote refinery go reduce di price of da petroleum product as dem don "lower di price to N970 per litre on November 24, and now announce new price of N899.50 per litre."
Anthony Chiejina, di company tok-tok pesin say dem don introduce special offer special offer to benefit consumers as dem go begin to allow consumers to purchase additional litre of fuel on credit for every litre wey dem buy on cash basis.
"To alleviate transport costs during dis holiday season, Dangote Refinery dey offer holiday discount on PMS. From today, our petrol go dey available at N899.50 per litre for our truck loading gantry or SPM. Furthermore, for every litre purchased on cash basis, consumers go get di opportunity to buy another litre on credit, back by bank guarantee from Access Bank, First Bank, or Zenith Bank," Chiejina tok.
Di tok-tok pesin say di refinery dey commitment to ensuring Nigerians get access to premium quality petroleum products wey dey competitive priced, as well as environmentally and engine friendly.
Chiejina tok say di refinery operations mark di end of Nigeria as di dumping ground for substandard and 'blended' imported products, wey dey dangerous to human health, machinery, and di environment.
Dangote Refinery, dey produce 650,000 barrels per day (BPD), dis an di largest single-train refinery in di world.
As long as crude oil prices dey within di price of $70 per barrel, petrol prices go dey go down or stabilise in di coming days.
But NNPCL neva still reflect dis new change of dia prices for filling stations.









