Court find Dominique Pelicot, Gisèle Pelicot ex-husband and 50 oda men guilty of mass rape

Wia dis foto come from, Reuters
Judges for di French city of Avignon don sentence Dominique Pelicot, Gisele Pelicot ex-husband to 20 years imprisonment.
Dis na on top accuse say e dey guilty of aggravated rape for one mass rape trial.
Di court also find 47 of di men guilty of rape, two guilty of attempted rape, and two guilty of sexual assault.
Dem dey sentenced to various jail terms. While some chop jail-term wey dey as low as three years imprisonment, odas get 5, 6, 9, 10, and 12 years.
For almost a decade, Gisèle Pelicot ex-husband Dominique drug and rape her and go invite plenty oda men wey e recruit online to have sex wit her on top her bed for dia house while she was unconscious and no know.
Although Dominique Pelicot admit to di charges but most of di oda men wey bin dey on trial deny wetin dem do as rape.
Court also find Dominique guilty of attempted aggravated rape on anoda man wife.
Dominique Pelicot no show any emotion as di judge deliver im verdict but e
Di sentences of di oda 50 men

Wia dis foto come from, Reuters
Jean-Pierre Marechal dey sentenced to 12 years. Prosecutors bin ask for 17 years.
Court find am guilty of attempted rape plus serious rape of im wife, also on top accuse say e drug her.
The 63-year-old earlier bin earlier admit say im dey follow Dominique foot step. E drug im own wife for five year, rape her and invite Dominique to rape her too.
Jacques Cubeau dey sentenced to five years. At 73, Jacques Cubeau na one of di oldest co-accused on trial.
E be lorry driver wey bin spend most of im life for road throughout Europe. E be divorced father of two.
Cyrille Delville dey sentenced to eight years. Di father-of-two and former football player bin admit to rape.
Lionel Rodriguez dey sentenced to eight years. Di 44-year-old na employee for di same supermarket wia dem catch Dominique Pelicot dey do bad thing for 2020.
Christian Lescole dey sentenced to nine years.
Charly Arbo dey sentenced to 13 years.
Nicolas Francois dey sentenced to eight years and e dey banned from doing jobs wey involve children for several years.
Boris Moulin dey sentenced to eight years.
Philippe Leleu dey sentenced to five years of which two are suspended.
Joseph Cocco dey sentenced to three years.
Fabien Sotton dey sentenced to 11 years.
Nizar Hamida dey sentenced to 10 years.
Joan Kawai dey sentenced to 10 years.
Husamettin Dogan dey sentenced to nine years.
Hughes Malago dey sentenced to five years.
Andy Rodriguez dey sentenced to six years.
Jean Tirano dey sentenced to eight years. For court, e bin tok say im no remember say im rape Gisèle Pelicot, e claim say Dominique Pelicot drug am (something wey Dominique deny).
Thierry Postat dey sentenced to 12 years. E also dey banned from working wit children for life.
Redouane El Farihi dey sentenced to eight years.
Simone Mekenese dey sentenced to nine years. Di construction worker and father-of-six na di only defendant Gisele recognise, e dey live next door to di Pelicots. Dominique bin invite am come dia house one time to see Gisèle, under di disguise say im wan sell bike tyre to am. Dominique Pelicot "manipulate me and I fall into im trap," Mekenese tok for court.
Thierry Parisis dey sentenced to eight years. Court also order sake make most of these men take treatment.
Jean-Marc LeLoup dey sentenced to six years.
Patrick Aron dey sentenced to six years, but e go waka free today as e get medical issues and dem go need put am for special jail, according to di judge.
Mohamed Rafaa dey sentenced to eight years.
Mahdi Daoudi dey sentenced to eight years.
Ahmed Tbarik dey sentenced to eight years.
Patrice Nicolle dey sentenced to eight years.
Grégory Serviol dey sentenced to eight years.
Abdelali Dallal dey sentenced to eight years, but go waka free today sake of medical issues and dem go need put am for special jail, according to di judge.
Jean-Luc LA dey sentenced to 10 years.
Quentin Hennebert dey sentenced to seven years.
Saifeddine Ghabi dey sentenced to three years.
Romain Vandevelde dey sentenced to 15 years.
Ludovick Blemeur dey sentenced to seven years.
Cedric Grassot dey sentenced to 12 years.
Cendric Venzin dey sentenced to nine years.
Hassan Ouamou receive 12 years. Di 30-year-old currently dey on di run for Morocco. E also tell investigators say im no get intention of returning to France.
Di defendants get 10 days to appeal.
Di president of di court, Roger Arata, tok say all di defendants go get di time to follow dia lawyers tok bifor dem go jail.
Gisele reaction to di verdict

Wia dis foto come from, Reuters
Gisele bin rest her head on di wall for di court rod as her ex-husband bin dey sentenced, BBC reporter for court tok.
She look at di defendants as dem stand up wen di judges read out dia verdicts.
No oda real reaction from her or her children. But di family no look happy.
Na her decision to waive her anonymity and throw dis for open.
Wetin di case dey all about?
From 2011 to 2020, Dominique Pelicot bin pile im wife wit tranquilising drugs and sleeping pills without her knowledge. She go crush dem into powder and add dem to her food and drink.
Gisèle Pelicot bin suffer memory loss and blackouts sake of di drugs and she tok of 10 years of her life wey she don lose.
Dem eventually catch am becos one security guard report am to police sake of say e take photographs under women skirts for one supermarket.
"I think say we be close couple," she bin tell di court one time. Instead, her husband bin de yenta one notorious but now banned website wey im name na Coco.fr to invite local men to dia home to have sex wit her while she dey for comatose.
"I dey sacrificed on di altar of vice," Gisèle Pelicot tok early for di trial.










