Who be di two pipo wey die for car accident wey involve Anthony Joshua

Di late Sina Ghami wear short sleeve two-piece cloth wey resemble light pink e hold tea cup for hand as e sitdown for chair dey look sideways into di camera. Kevin Ayodele wear balck sibglet with black face cap wey get logo wey no too clear. E pose as e sit for chair dey display im muscles.

Wia dis foto come from, Instagram / @sina_evolve, @healthy_mindset

Wetin we call dis foto, Sina Ghami/Kevin Ayodele
Read am in 5 mins

According to di Director General of di National Sports Commission (NSC), Hon. Bukola Olopade di two pipo wey kpai na Joshua strength and conditioning coach, Sina Ghami and personal trainer, Kevin Latif Ayodele.

"Unfortunately, Joshua strength and conditioning coach, Sina Ghami and personal trainer, Kevin Latif Ayodele lose dia lives for di crash.

For di statement e express deep sympathy to Anthony Joshua wey e describe as " global boxing star, and di families of di victims wey dey involved in a fatal road accident.

Hon. Olopade describe di accident as tragic and wetin dey sad well-well. Im also tank God say Anthony Joshua survive.

Di Director -General, don go visit di former world heavyweight boxing champion, on behalf of di chairman of di Commission, Mallam Shehu Dikko.

Na five men wey dey involved for di accident, out of di five, two escape while one, Anthony Joshua get minor injuries.

According to Federal Road Safety Corps [FRSC], "di pipo wey wound dey receive medical attention. Dem don also put di deadbody of di pipo wey die for di Livewell Morgue, Ajaka, Sagamu."

Long truck wey dey parked for side of di road wey get accident
Wetin we call dis foto, Di truck wey Anthony Joshua car jam for di accident wey kill im strength trainer and conditioning coach

Tinubu, politicians, world of boxing, celebrities and fans pay tribute

Tributes don begin pour in for Sina Ghami and Latif Ayodele, wey die for di crash for Nigeria, from di world of boxing and beyond.

Eddie Hearn, chairman of Anthony Joshua promoter company Matchroom, pay tribute to Sina Ghami and Latif "Latz" Ayodele.

"Wit di heaviest of hearts," e post on Instagram.

"Two great men. Rest in eternal peace Sina and Latz. My thoughts and deepest prayers dey wit everyone."

Boxer Chris Eubank Jr post on X say: "Thank God our heavyweight champ survive dat horrible car crash. And pray for di two fallen sojas Latz & Sina plus dia families. I sabi both… dem be genuinely good men. Rest in Peace boys."

YouTuber-wey turn-boxer Jake Paul, wey lose to Anthony Joshua earlier dis month, post: "RIP Sina Ghami and Kevin 'Latif / Latz' Ayodele. My thoughts and prayers dey wit dia families and friends and AJ."

Former New Zealand rugby star and boxer Sonny Bill Williams post fotos wit Joshua and Latif, and add say: "Rest easy brother Abdul Latif, may di most high make am easy for your loved ones."

British bantamweight Shannon Courtenay say: "RIP Sina and Latz, two good guys. Last week all of us bin dey have fun for Miami and today you don go, life really is too short. May di Lord look ova dia loved ones during dis awful time."

Leader of di Conservative Party, Kemi Badenoch post wit foto of she and AJ say:" Wishing strength, healing, and peace to di remarkable Anthony Joshua afta today tragic incident.

My thoughts, prayers and best wishes dey wit you and yours plus all di families wey dey affected.

Nigeria President Bola Tinubu join millions of Nigerians wey include politicians, celebrities and fans to also extend dia condolences to pipo wey die for di crash.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post

Profile of Sina Ghami/Kevin Ayodele

Sina Ghami na Joshua strength and conditioning coach of more dan 10 years, e help am prepare for major clashes for im career including dis month victory, wey e beat Jake Paul.

E also co-found Evolve Gym for London. Di gym website say Ghami na qualified sports and exercise rehabilitator wey specialise in musculoskeletal injuries and corrective exercise.

Di gym say dem go close on 30 December "as we mourn di loss of our beloved owner".

E don work wit athletes for di National Football League (NFL), National Basketball Association (NBA) and Michigan State University football team.

Sina bin don also work with many big name athletes like Le'Veon Bell from di Pittsburgh Steelers (NFL) and Draymond Green from di Golden State Warriors (NBA).

Latif "Latz" Ayodele na Joshua personal trainer.

Im passion for di gym dey clear on im social media pages, as im dedication to Islam.

"Finding Islam for 2012 has been my biggest blessing," e write for one pinned post from 2020.