Afcon 2025: Morocco, South Africa, Mali join list of kontris wey don qualify for knock-out round

Mohamed Salah of Egypt wear dia national jersey, red shirt and white shorts wey get black design, di red shirt get black design for di neck and number wey dem write wit white colour. Victor Osimhen of Nigeria wit mask for face, wear di flowered green national shirt wit black design and di number 9 wey dem write wit white colour, Riyad Mahrez of Algeria wear dia national white jersey wit a touch of green stripes im wear red captain band and di number 7 dey for green colour

Wia dis foto come from, Visionhaus/Getty Images, FRANCK FIFE / AFP via Getty Images)

Wetin we call dis foto, Mohamed Salah, Egypt/Victor Osimhen, Nigeria/ Riyad Mahrez, Algeria
Read am in 4 mins

Kontris don begin qualify for di knock-out stage of di 2025 Africa Cup of Nations [Afcon] as di last round of di Group phase matches go start on Monday.

Dis na di stage wia dem dey separate di boys from men as some teams still dey struggle to get chance to qualify for di next round.

Nigeria Super Eagles, Egypt and Algeria first book dia place for di knockout stage last week.

Dis week, kontris like di host nation Morocco don join. As di last round of matches continue on Wednesday, more kontris go book dia place for di Round of 16.

Countries wey don qualify for knock-out round

According to di 2025 Afcon table, teams wey win dia first two matches go automatically qualify for di next round sake of say two wins don already give dem six points out of possible nine points.

Dis countries include: Nigeria, Egypt, Algeria, Morocco, South Africa, Tunisia and Mali

Group A: The Atlas Lions of Morocco na di latest to qualify for di Round of 16. Dem top dia group wit seven points.

Morocco whip Zimbabwe 3-0 while Mali and Comoros play goalless draw.

Malijoin Morocco for di group wit only three points.

Group B: Egyptna di first team wey qualify for di knock-out stage for Group A.

Di Pharoahs play goalless draw with Angola. Egypt top dia group wit seven points total.

Dem bin get six points afta dem beat Zimbabwe 2-1 for dia first match and also beat South Africa 1-0 for dia second match.

South Africa also qualify behind Egypt wit six points.

Group C: Di Super Eagles top Group C wit nine points for di first time since 2021.

Dem win all dia group matches especially di last match against Uganda wey end 3-1 on Tuesday.

Nigeria bin defeat di Taifa Stars of Tanzania 1-0 for dia first match before dem beat Tunisia 3-2 for di five goals thriller on Saturday.

Tunisia finish second of di group wit four points.

Group D: Senegal and DR Congo finish wit seven points each.

Senegal manage top di group sake of goals difference. Senegal get six goals while DR Congo get four. Di two kontris qualify for di next round.

Group E: Algeria qualify from Group E with six points.

Di Desert Foxes beat Burkina Faso 1-0 for dia second.

Dem sama Sudan 3-0 for dia opening game for di 2025 Afcon.

Algeria go face tough test against Equatorial Guinea on Wednesday.

Countries wey no qualify

As Afcon Group matches continue, some countries don play for di tournament finish afta di last round of group games. Dis countries include:

Group A: Comoros and Zambia

Group B: Angola and Zimbabwe

Group C: Tanzania and Uganda

Group D: Benin Republic and Botswana

Action still dey for Group E, di fight dey between Burkina Faso and Sudan.

For Group F, defending champions Ivory Coast and Cameroon put leg inside one trouser as dem get four points each while Botswana get three points.

Ivory Coast need to qualify if dem wan defend dia title wey dem win for 2023.

Cameroon too wan make statement, at least make dem show say even though dem miss out on di 2026 World Cup, make dia fans use Afcon hold body.

Gabon and Ivory Coast go clash on Wednesday as Mozambique and Cameroon dey prepare too.