Nigeria top Group C wit nine points afta win against Uganda

Super Eagles players wit dia national team jersey.

Wia dis foto come from, Abdel Majid BZIOUAT / AFP via Getty Images)

Wetin we call dis foto, Raphael Onyedika celebrates wit teammates afta di Africa Cup of Nations Group C football match between Uganda and Nigeria wia e score two goals.
Read am in 7 mins

Nigeria top Group C for di 2025 Africa Cup of Nations afta dem beat Uganda 3-1 for dia last Group match.

Nigeria Super Eagles score dia opening goal for di 2th minute wen Paul Onuachu fire di ball inside net.

Raphael Onyedika later score two goals for di 62nd and 67th minute.

Di match hot well-well and full of action as Uganda wey disturb Nigeria defence mostly for di first half bin get injury.

Dem later change di Uganda first choice goalkeeper Onyango and bring in dia second goalkeeper Selim.

E no last for beta ten minutes before Selim collect Red card sake of handball.

Seliom use im hand stop Victor Osimhen goal bound ball as e comot from line to catch di ball.

Uganda dey force to remove anoda player so dat dem fit bring in dia third choice goalkeeper Alioonzi.

Wit all di drama wey hapun for di match, Uganda still show fighting spirit as dem score through Mato for di 75th minute.

Even wit ten men for field, Uganda still show say dem no come Afcon to play.

Nigeria and Tunisia qualify from Group C while Tanzania finish third and Uganda dey bottom wit 1 point.

Ademola Lookman wear Nigeria black and green flowered jersey, e wear black head band as e dey celebrate goal. Denis Omendi wear Uganda white shorts and shirt bwey get black design as e dey celebrate goal .

Wia dis foto come from, Phill Magakoe / AFP via Getty Images/Abdel Majid BZIOUAT / AFP via Getty Images)

Wetin we call dis foto, Ademola Lookman, Nigeria/ Denis Omendi, Uganda

Match Highlights

Second Half

Nigeria 3-1 Uganda

90+4' Full Time

90+4' Corner kick for Uganda dem play am but notin come out

90+3 Substitution for Nigeria, Chukwueze don comot as Lawal replace am.

90+2' Nigeria just dey carry ball dey run for field to get more ball possesssion. Di tempo of di ball don come down.

90' Referee add four minutes

90' Chidozie Awaziem of Nigeria collect yellow card afta e foul Uganda player wit im elbow.

89' Uganda dey try to see if dem fit score anoda goal before match go end. Na few minutes remain.

85' Substitution for Nigeria, Victor Osimhen wey captain di team ntoday don play finish, Akor don replace am.

82' Freekick for Nigeria, dem play but Uganda goalkeeper Alionzi catch di freekick.

80' Osimhen of Nigeria dey evriwia for di field e dey assist evribody to score.

75' Mato of Uganda score dia first goal against Nigeria im collect one long pass, Nigeria goalkeeper Uzoho comot from goal line to come catch di ball but Mato put di ball inside net wey cross Uzoho.

75' GOALLLLLLL FOR UGANDA

74' Moses Simon of Nigeria miss beta chance to make am 4 goals as e fall wen e play di ball give Uganda goalkeeper.

72'Nigeria dey carry Uganda dey do training for field since dem score di third goal.

Nigeria 3-0 Uganda

67' Onyedika of Nigeria slot di ball into di net afta beta passes for Uganda goal area.

67' GOALLLLLL FOR NIGERIA

66' Ikpeazu of Uganda collect yellow card

Nigeria 2-0 Uganda

63' Samuel Chukwueze of Nigeria pass ball to Onyedika for di Uganda goal area, Onyedika put di ball inside net wit im first touch.

63' GOALLLLLL FOR NIGERIA

61' Nigeria dey play Uganda now wit 10 men

61' Nigeria play di freekick from di red card but notin come out from am.

59' Substitution! Uganda dey forced to sub player so dat dem fit bring in dia third goalkeeper. Alhassan comot and Nafian Alionzi enta.

57' Selim wey be di new Uganda goalkeeper wey just enta don collect Red card afta e use hand stop goal bound ball wey Victor Osimhen of Nigeria dey play.

57' RED CARD!!! for Uganda goalkeeper

53' Freekick for Nigeria afta Samuel Chukwueze win am for Nigeria but notin come out.

50' Chance for Nigeria! Bruna fire di ball go side netting.

46' Calvin Bassey don comot, Chidozie Awaziem don enta.

46' Nigeria substitution

46' Steven Mukwala don enta for Denis Omedi.

46' Salim Magoola replace Denis Onyango wey be Uganda goalkeeper.

46' Uganda do substitutions Allan Okello don replace Travis Mutyaba.

46' Second half don start

First Half

Nigeria 1-0 Uganda

45+5' Half -time

45+4' Freekick for Nigeria and na Chukwueze wan play am. E play di ball but e bounce back.

45+2' Di tempo of di match don cool down small as Nigeria hold possession of di ball.

45' Referee add four minutes.

45' Uganda play di freekick wey make Paul Onuachu and Ikpeazu of Uganda kwanta but notin come out.

43' Uganda get freekick afta Nigeria defender Alebiosu fall ontop Uganda player body. Alebiosu bin no dey look front as e bin dey follow di ball.

41' Nigeria dey press Uganda wit back to back attacks all di shots just dey rebound afta Uganda defenders dey try save am.

39' Nigeria miss beta chance to score afta Paul Onuachu no put leg quick for ball wey Moses Simon give am. Onyango narrowly save di ball wey make im injury worse. Dem wan change am but im still dey manage till half-time.

37' Dele Bashiru of Nigeria just dey play foul any how and referee don dey warn am. So far Nigeria don commit six fouls while Uganda get only one.

35' Game continue, Uganda goalkeeper Onyango still dey game.

32' Uganda goalkeeper Onyanga get injury again. E be like say dem wan change am.

30' Uganda dey try to catch di pace of Nigeria but e neva work so far.

28' Paul Onuachu bin don miss beta chance afta Victor Osimhen pass ball give am a minute earlier.

28' Dele Bashiru of Nigeria pass di ball to Onuachu wey fire am inside di net.

Nigeria 1-0 Uganda

28' GOAL!!!!!! FOR NIGERIA

23' Uganda goalkeeper don standup afta e collect small treatment game don continue.

22' Uganda goalkeeper Onyango don get injury, e land wrongly kon sprain im leg, medical team dey attend to am.

20' Nigeria players full for Uganda goal area, dem dey try short-short passes to find space enta Uganda goal post but Uganda defenders no gree for Nigeria at all.

18' Nigeria no wan give Uganda chance at all ooooo, however, Francis Uzoho dey try for goal post.

16' Small stats for di match show say Attacks of both sides tie wrapper o! Nigeria and Uganda don get 10 attacks so far.

14' Alebiosu of Nigeria fall for ground afta Uganda player run ova am wen dem dey chase di ball.

12' Nigeria dey press Uganda and dem dey try to score but Uganda talisman Denis Omedi no dey give Nigeria defence chance.

9' Nigeria get chance to make goal attempt for Uganda goal area but Chukwueze miss di chance.

8' Match don resume and Uganda dey hold di ball for di past few seconds.

7' Uganda player fall down and e dey get medical attention.

5' Uganda play di freekick go wide!

4' Calvin Bassey of Nigeria collect yellow card afta e foul Uganda goalkeeper, referee award freekick to Uganda.

2' Osimhen of Nigeria carry ball dey go Uganda goal area but Linesman raise flag for offside.

1' Match don start