Religion get role to play for sport?

Jeremiah get im hands on im head and dey look up. E dey wear a white "100% Jesus" sweat band on im forehead. E dey wear a GB vest wit dark blue and white stripes.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Jeremiah Azu run for Team GB for di men 100m semi-final for di World Athletics Championships Tokyo 2025
    • Author, Lizzy Bella
    • Author, Georgia Levy-Collins
    • Role, BBC Newsbeat
  • Read am in 5 mins

Wen Crystal Palace Marc Guehi score against Arsenal on Tuesday night, e do wetin e dey always do - to point to di sky.

Arsenal Jurrien Timber wey dem nickname 'Pastor Timber' by fans, also do like dat wen e score for di penalty shoot-out for di end of di game.

Both teams get influential players wey don recently dey discuss di importance of dia Christian beliefs.

And no be just for football wia we don see different headlines about professional athletes wey dey display dia faith.

Earlier dis year, for di World Athletics Championships for Tokyo, dem warn GB sprinter Jeremiah Azu make e no wear im "100% Jesus" headband.

But your beliefs fit impact your performance and how you dey treated for di sport you dey play?

Crystal Palace Marc Guehi dey look up to di sky and dey point. Several of im team mates dey hug am from behind. Dem dey all wear gold jerseys.

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Crystal Palace Marc Guehi celebrate afta e score against Arsenal for Emirates Stadium

Sport govning bodies often get rules against displaying religious and political slogans during competition.

Jeremiah no dey formally punished for wearing im "100% Jesus" headband for di 400m semi-final, but World Athletics bosses say dem speak to im team about di accessory.

Di 24-year-old say e now back di rules wey dey separate religion from di track, but e happy say e do am.

E tell BBC Newsbeat say e believe im "strength" come from im faith, and e wear di headband to show dat.

Im papa na pastor, so Jeremiah say religion always dey part of im life.

"We read di Bible for house, we pray for house," e remember.

E say im religion dey help im performance for athletics.

"As a Christian you gats dey disciplined," e say na dat trait e transfers to track and field.

"E get day wia e dey difficult to push, but I know say di discipline I get na from my faith," e explain.

Zainab dey wear a black hijab and a black North Face coat. Jaiden dey wear a black puffer coat. Dem stay side-by-side for one field wit trees in di distance.
Wetin we call dis foto, Semi-pro footballers Zainab El-Mouden (left) and Jaiden Chang-Brown na devotees to dia religions

Though Jeremiah say e neva feel like say dem shut am up wen e dey tok about im faith but upcoming athletes tell BBC Newsbeat say e no always dey dat simple.

Semi-pro footballer Zainab El-Mouden, wey dey play for Chesham United FC Women, say she get challenges as female Muslim player wey dey wear hijab.

Dem dey wear di garment ova di head as display of modesty, but dem no dey always welcome dis kain dressing on di football pitch.

Govning body Fifa ban am until 2014, wen players dey permitted to wear am for religious reasons.

And just two years ago, Moroccan defender Nouhaila Benzina, 27, make history by becoming di first player to wear hijab for World Cup.

Zainab, 22, say her faith mean evritin to her, from di way she conduct hersef to di way she dey dress.

She say na real journey to become comfortable wearing hijab while playing football.

"First I hate am, I hate di way e look for my bodi," she tok.

"My hijab na biggest insecurity and den e become my biggest strength.

"Weda you want to or not, you go see me and you go watch me more dan anyone else."

Zainab feel say e still get difference for how male Muslim players dey treated compared to female players.

"Wit a female Muslim player, dem dey visibly different so na dia I tink say di wahala dey come from," she tok.

Afta growing up witout anyone wey "look like" her for football to inspire her, Zainab say she wan be dat role model for odas.

"All di girls wey dey grow up now need dat representation to play," she tok.

Shey faith dey affect your performance for sport ?

E get studies on how positive mindset and confidence fit influence your performance.

Religion no dey always be part of am - many athletes get rituals dem "gazt" follow bifor big game or race to centre demsefs.

Some report say dia faith form part of preparations for big event.

One Seoul University study wey dem publish for 2000, based on interviews wit 180 sports pipo across 41 sports, bin identify prayer as one of seven main "coping strategies" dose wey dem kwesion bin dey use to combat anxiety bifor big event.

E suggest say dis fit get positive effect on dia performance.

Semi-professional footballer Jaiden Chang-Brown, of Lingfield FC, tell BBC Newsbeat say im faith don help am manage im emotions for slightly different way.

"I feel like sometimes my passion fit get di better of me for di past," e tok.

"Sometimes I go shout at teammates.

"E really help to just give me peace wen I dey on di pitch."

Jaiden say im faith don help am improve im mindset and "tap into dat psychological side of football" wen e dey play.

Di 21-year-old describe imsef as "born-again Christian" and say im religion na di most important tin for im life.

"E dey bigger dan football, e dey bigger dan evritin," e tok.

"Pipo tink say e no dey cool to be bold for your faith, but e dey cool. You fit laugh and do yeye, but na wetin I believe in."