Meet Nouhaila Benzina, di first player to wear hijab for World Cup

Nouhaila Benzina

Wia dis foto come from, Getty Images

Morocco defender Nouhaila Benzina don make history as she become di first player to wear a hijab at a World Cup.

Di 25-year-old wear her Islamic headscarf wen she make her first appearance for di tournament wen her team win 1-0 ova South Korea.

Di wearing of coverings for religious reasons dey authorised by Fifa for 2014.

Morocco na one out of di eight team wey dey make dia debut for di Womens World Cup.

Benzina wey dey play her club football for Morocco na di first player wey go wear hijab for di senior women international tournament.

She no play for her team wen dem lose 6-0 for di hand of Germany for dia opening game.

Young Muslim footballers don say Nouhaila Benzina na dia role model afta she make di history.

Muslim girls and women dey wear di hijab as a display of modesty, but e no always dey dey welcomed on di football pitch.

Di wearing of head coverings for religious reasons bin dey authorised by Fifa for 2014.

Yasmin Rahman play for Saltley Stallions for Birmingham, one of di only clubs wey dey geared towards Muslim women for di UK.

Di 23-year-old say wen she dey younger, she no get Muslim female football player to look up to.

Little me dey scream 'oh my gosh', finally now a hijab for di level of di World Cup and being globally recognised," she tell BBC Newsbeat.

But Yasmin, wey dey work as a civil engineer, say she no want am to end with Benzina being in a hijab on di global stage.

"I wan see more Muslim women going out dia and doing it.

"My family don dey very supportive and dem know say I don dey play football since I dey small.

"You want everyone to dey accepted as dem dey and do whatever dem dey do."

Asma Hassan decide to join Saltley Stallions afta wanting to try football for years but she bin feel like say na male-dominated sport.

"If I bin see someone like [Benzina] wen I dey younger, e for push me to play football at a younger age," she tok.

"E dey so so nice to see someone wey look like you. She really be role model to us." She tok.

Di hijab in football and im road to di Women World Cup get a long, complicated history.

Like di case for Canada wia 16 years ago wen Asmahan Mansour, wey be 11 years, bin line up alongside her team-mates to play for Canada.

But before di referee blow im whistle, Asmahan match don over.

Officials tell her say she go need to remove her hijab if she wan play because e go against rules set out by Fifa at di time.

Di issue go to di Canadian Soccer Association and den to Fifa demsefs, wey stand behind di ban and even drew up an official policy about am.

Dem say di risk of injury wey wearing head covers while playing football pose dey too great.

Campaigners say millions of girls around di world fit dey put off from playing a game wey pipo often dey see as being "for everyone".

Na so di efforts begin to reach some kind of deal wey allow Muslim females to play with a hijab.