Wetin we sabi about di alleged Abuja BBA school bullying

Beautiful Beginning Academy logo

Wia dis foto come from, Beautiful Beginning Academy

    • Author, Tamara Ebiwei
    • Role, Broadcast Journalist
    • Reporting from, Abuja, Nigeria
  • Read am in 6 mins

Federal Capital Territory (FCT) Police Command say dem dey investigate di alleged bullying of one junior student by senior students of di Beautiful Beginning Academy Abuja.

On 2 December, 2024 one video wey go viral on social media appear to show wia senior students of di school loosely tie one junior student wit chain around im neck.

Di video also show as di junior student kneel for ground dey smile and make gestures as voices of di senior students dey tell am make e smile and make dos gestures.

FCT Police Command tok-tok pesin, Josephine Adeh tell BBC Pidgin say "we dey on di mata and investigation dey go on".

She explain say nobody, including di school and di family of di alleged victim officially report to dem, but as dem hear di mata di Police take proactive steps to locate di school and start investigation sharp-sharp.

"We go inform di public wen we conclude investigation," Josephine Adeh tok.

Meanwhile, di school authority tell BBC Pidgin say" na play di students bin dey play and dem don take disciplinary action against di students wey dey involved."

Wetin really happun

According to one eyewitness, wey be one of di students wey dey di room wen evritin happun, im say true -true na play dem bin dey play.

David wey be final year student Senior Secondary three narrate wetin happun to BBC Pidgin.

"I bin no dey dia from beginning, but from wen I come back to my room, I see Imtiaz ( di alleged victim wey be Senior Secondary two student) as im lie down for floor wit chain wey no tight around im neck.

"I also see as dem dey do video recording and na Sadiq (classmate of David and di oda boys) wey dey record di video."

"Imtiaz tell Sadiq to record di video so Sadiq record di video," e claim.

David add say di school authority dey collect dia phones and tablets except dem wan use am study, and dem go return am wen dia study time finish.

"So di phone wey Sadiq use record di video na one Day student get am and di student bin leave di tablet for school, so Imtiaz give Sadiq di tablet wey di Day student leave for school to use record di video."

"Dis tin happun around 7pm in di evening afta dinner, so Imtiaz tell Sadiq to record di video and afta im record finish, all of us pose to snap picture, den Imtiaz say im wan see di video, afta im see am finish, im tok say im like di video."

"Even for di video you go see as him (Imtiaz dey smile and make hand gestures.

"Afta we finish, Imtiaz ask for di tablet, im con enta Snapchat con send di video to im account, den im delete di video from di tablet sake of say na junior student get di tablet and im no want di student to see di video."

David say di mata no end dia becos di next day, Imtiaz collect anoda junior student tablet wey im use log into im personal account for Snapchat and na from dia Imtiaz send di video to im broda.

Im maintain say di student wey Imtiaz use im tablet log into im Snapchat account send screenshot of di message wey Imtiaz send im brother.

"I no want make mummy see dis video, I just want go home, see wetin dey happun to me, I no want make mummy see am"

David say from Imtiaz elder broda response, dem no dey Abuja, dem dey Gombe.

So on Monday Imtiaz sisters come di school to con carry am go house afta dem see di video.

"So e be like wetin dem plan" David conclude.

'My pikin dey traumatised' - Parent

One of di parents wey im pikin dey inside di viral video, Alhaji Muhammed Ibrahim say im pikin don dey di school for almost 15 years.

Im say im pikin wey be final year student dey traumatised by di incident wey happun becos for dem as children, dem no beliv say 'ordinary play' wey im dey play wit im school mates for dia hostel room go cause dia kain kasala especially wit anoda family wey dey accuse dem of bullying.

"My pikin dey on admission for hospital, imagine to carry a 14 year old boy to Commissioner of Police office, you still carry am go meet di Minister of Education for di first time and im don also meet different pipo sake of different issues wey relate to dis mata.

E don create fear already, and di trauma start from di video wey di alleged victim family post online, as im see am online alone, na big blow for am"

"My pikin no dey fit eat well, im dey tink about different tins for im head, I just dey assure am say no problem wey no go pass and make im learn from dis experience"

"Going forward, I don advice am as a father make im no bully anybody and make nobody bully am in future"

'We suspend dem indefinitely' - MD

Authorities of di Beautiful Beginning Academy (BBA) Abuja wia bullying allegedly happun last month clear di air about wetin really happun for di viral video.

However, di school authority say afta dia investigation dem find out say "na play di students bin dey play no be bullying"

Di school add say dem don warn di students make dem no eva play dat kind of play again and dem don take "disciplinary action" against di students.

Mrs Rosemary Nasa-Okolie wey be di Managing Director of di school tell BBC Pidgin say she no know wetin bin dey happun until di alleged sisters of Imitiyas come di school on 2 December and accuse her school of bullying wit di viral video as evidence wit a request to expel di children.

"Imtiaz Bello na pikin wey no go fit hide dis kain tin, im don dey our school for 13 years and im know di reporting system, so e shock me, I con tell her to sitdown make I listen to her, she open her phone show me video say if I no expel di children di video will go online"

"I no know who she be but she introduce hersef as Imtiaz sister. Wen I ask of Imtiaz mum wey di school know as parent and guardian she dey shout dey insist say she go send di video to social media.

"I tell her say process dey to expel di children but dem dey SS3 now, make she allow us investigate and take disciplinary action afta our findings."

She say Ministry of Education and different groups don call her sake of dis video.

According to her, di Ministry of Education say make dem lift di indefinite suspension of di students soon so dat dem fit prepare for dia final exams.

BBC Pidgin dey try to reach out to the family of Imtiaz Bello but dem no gree answer calls and reply text messages wey BBC correspondent send to dem.

Bullying for Nigeria

Bullying dey happun for schools for Nigeria as di kontri don witness some cases. But di one wey shake Nigeria well-well happun for December, 2021.

Nigerians bin demand justice sake of Sylvester Oromoni as di Dowen College student bin allegedly die sake of alleged bullying.

Na more dan 180,000 pipo bin have sign petitions wey bin demand justice afta di death of di 12-year-old boarding school pupil in Nigeria.

Sylvester Oromoni family bin accuse five fellow students at Dowen College in Lagos say dem torture am becos im no gree to join one cult group.

Im death make Nigerians vex and authorities bin close di school indefinitely.