Minimum tolerable score, entry age, and oda policies stakeholders agree on for Jamb 2024 policy meeting

Students writing Jamb

Wia dis foto come from, Jamb

Read am in 3 mins

Di Joint Admission and Matriculation Board (Jamb) for dia policy meeting on Wednesday, 18 July agree wit stakeholders to set some policies for Nigerian students wey dey apply to higher institutions across di kontri.

For dia 2024 policy meeting for Abuja, Nigeria capital, on Thursday, 18 July, Jamb and dia stakeholders wey include different higher institutions agree say di Board minimum tolerable score for admission into universities go be 140.

Dem also agree say di minimum tolerable score for admission into polytechnics and colleges of education go be 100.

Jamb also tok say evri institution fit peg dia own minimum tolerable scores wey dey acceptable but dem no dey allowed to reduce di Jamb minimum tolerable scores for di 2024 admission year.

According to di Board, any institution wey change dia minimum tolerable score policy for Senate afta dem don submit a particular one to Jamb gatz know say e no go take effect dat same year but di subsequent year.

"No candidate dey eligible for admission if e no score di UTME minimum tolerable score set by di institution," Professor Oloyede tok.

Nigeria Minister of Education Tahir Mamman, vice-chancellors, rectors and registrars of higher institutions and oda stakeholders bin dey di meeting.

Entry age into higher institutions

Di Minister of Education, Tahir Mamman, tok say 18 years old na di required age for admission into tertiary institutions for Nigeria.

Mamman tok say di 18 years benchmark dey in line wit di 6-3-3-4 system of education.

E say im position dey backed by Nigeria law wey guide admissions into tertiary institutions. Mamman say e no suppose require a statement from am for admission bodis to take dis into consideration.

“Our laws require students to dey in school from six years – Yes, e get dose wey do dat from five – and remain in primary school for six years, basic education for three years, and secondary school for three years. E no require a statement of di minister. We dey only restate wetin dey di law," e tok.

However, afta deliberations wit vice-chancellors, Jamb registrar Professor Oloyede announce say 16 years old go be di age of consideration for 2024 academic year but e go change to 18 years from 2025.

Jamb also tok say candidates gatz get NIN to create account for examination registration.

Di Board say dem go verify Direct Entry (DE) candidates bifor dem go gain admission into university and afta dem graduate from di university.

Oda entry requirements

“No institution fit recommend or admit any candidate for DE wit less dan two points, you know say di highest na sixteen and di lowest na two. No candidate for DE go get less dan two but e no mean say make you admit two. You go determine wetin you wan take as your own minimum for direct entry.

Professor Oloyede also tok say no institution dey allowed to add further expenses for admission screening of students into di university.

E tok say Jamb go give all institutions access to photograph images and fingerprints data of all candidates to cut substitution and impersonation of candidates .

“No institution dey allowed to recapture photographs or biometrics from any candidates but rather make dem depend on di biometrics wey Jamb don give di institution for dia admission," e tok.