Reduce risk of heart disease and stroke, help wit healthy weight loss and oda health benefits cashew nuts

Wia dis foto come from, Grace Cary Via Getty Images
- Author, Nicola Shubrook
- Role, BBC Good Food
- Read am in 5 mins
Discova some ogbonge facts about cashew nuts, including weda dis nuts dey good for your nor not.
Wetin be cashew nuts?
Na nuts dem dey call cashew, but botanically dem dey classified as seeds becos dem come from di fruit of di cashew tree (also known as drupe). Drupes na fruits wey get flesh on di outside but contain shell wit seed inside. Cashew trees belong to one group of plants called Anacardiaceae, wey include mango, sumac, and poison ivy.
Cashew trees dey grow for warmer climates, such as India and Vietnam, wey dey among di world largest producers of cashew nuts.
Cashews na small, kidney-shaped, pale yellow, and get rich, nutty flavour wey dey slightly sweeter dan peanuts. You fit chop am raw, roasted, as nut butter, or cooked in curries, stir-fries, and pastries.
Nutritional profile of cashew nuts

Wia dis foto come from, Clément Tardif via Getty Images
- 166 kcal/695 kJ
- 5.5g of protein
- 13g of fat
- 9g of carbohydrates
- 1g of fibre.
- 2 mg of iron
- 88 mg of magnesium
- 1.7 mg of zinc
From nutritional standpoint, cashews na good source of protein and unsaturated fats. A 30g serving contain approximately 160 calories, but becos dem dey rich in protein and unsaturated fats, dem dey provide greater feeling of fullness.
Dis portion also provide about 20% of your daily magnesium intake, wey dey important for hormonal health, and also contain manganese, selenium, iron, and zinc.
Health benefits of cashew nuts

Wia dis foto come from, AaronAmat via Getty Images
- Dem dey help protect against di narrowing of arteries.
- Dem fit help you live longer
- Dem contain antioxidants, to help protect against certain diseases
- Dem dey reduce di risk of heart disease and stroke
- Dem fit reduce di symptoms of osteoarthritis
- Dem fit help manage symptoms of colitis
- Dem fit help wit healthy weight loss.
- Dem fit help manage blood sugar
- Dem fit help reduce di risk of stroke
- Dem fit help prevent memory loss
Cashew nuts good for you?

Wia dis foto come from, Getty Images
1. Dem dey help protect against atherosclerosis and fit lower cholesterol levels
Cashews contain folate and vitamin E, wey dey help protect against blocked or narrowed arteries (atherosclerosis). One 2019 study also find say daily cashew consumption fit help improve cholesterol levels in pipo wit type 2 diabetes.
2. Dem fit help you live longer
Research don show say diets wey dey rich in unsaturated fats, such as dose found in cashew nuts, dey reduce di risk of overall and disease-specific mortality.
3. Dem dey help protect di bodi against oxidative stress
Ova time, oxidative stress fit damage organs, tissues, and even cells, potentially leading to various diseases such as Parkinson's, Alzheimer's, and multiple sclerosis. Antioxidants dey help to neutralise oxidative stress, and cashews na excellent source of antioxidants, particularly polyphenols and carotenoids.
4. Dem dey help reduce di risk of heart disease and stroke
Homocysteine na amino acid, but if levels become too high for bodi, e dey increase inflammation and therefore di risk of heart disease or stroke. Consuming cashew nuts don dey associated wit reduction in homocysteine levels for bodi.
5. Dem fit help reduce degeneration due to osteoarthritis
One 2020 study demonstrate say di combined benefits of antioxidants and anti-inflammatories from cashew nut consumption dey help combat di negative effects of osteoarthritis.
6. Dem fit help manage colitis
Colitis na inflammatory bowel disease, and research suggest say cashew nuts fit help reduce inflammation and manage colitis.
7. Dem fit help wit healthy weight loss
Research indicate say diets wey include higher intake of nuts, such as cashews, dey associated wit reduced weight gain and lower risk of obesity.
8. Dem fit help manage blood sugar
One 2019 study find say daily consumption of cashew nuts bin help improve insulin sensitivity, and therefore blood sugar management, in pipo wit diabetes. Dis na likely due to dia high protein and unsaturated fat content, wey contribute to healthy blood sugar regulation.
9. Dem fit help reduce di risk of stroke
Cashews na good source of magnesium, and research don show say higher blood levels of magnesium dey associated wit reduced risk of stroke.
10. Dem fit help protect against memory loss
Di good nutritional profile of cashew nuts – proteins, essential fats, vitamins and minerals – dey work togeda to help offer potential benefits against memory loss.
Cashew nuts safe for evribodi?
E dey possible to dey allergic to cashew nuts, and if you get any sign of allergic reaction such as difficult breathing, swelling of di face, tongue or lips, contact emergency services, as e fit dey life-threatening.
Pipo wey dey allergic to nuts dey more likely to dey allergic to cashew nuts.
Cashew cheese good for you?
Wen e come to vegan cheese, cashew cheese na one of di best choices becos e dey minimally processed and typically contain only cashew nuts and water, or perhaps a little lemon juice and yeast flakes.
Check di label wen you buy cashew cheese to make sure say e no contain lots of added extras like sugar or extra oil.
Di essentials…
Cashew nuts dey offer many health benefits and na good source of nutrients, including protein and unsaturated fats, as well as many vitamins and minerals.
Wit all nuts, you gatz consume dem in moderation as part of balanced diet, and e dey always preferable to eat dem raw instead of make you put salt or roast dem wit honey, wey fit no make you get dia natural health benefits.









