WAEC release May/June 2024 WASSCE results, tell candidates how to check am

Students siddon for exam hall

Wia dis foto come from, Getty Images

Read am in 5 mins

Di management of di West African Examinations Council (WAEC) don release results of di May/June 2024 West African Senior School Certificate Examination (WASSCE) on Monday, 12 August.

WAEC make di announcement on dia official X account and tok say candidates fit access dia result through SMS and waec website

Na 1,814,736 candidates wey dey 25,126 secondary schools for Nigeria bin register for di exam.

How candidates take perform

Of di number, na 1,805,216 candidates sidon for di exam. Di exam also dey administered to candidates from some schools for Benin Republic, Cote d’Ivoire and Equatorial Guinea, wia dem dey use Nigerian Senior Secondary School curriculum.

Out of di total number of candidates wey write di exam for Nigeria, 1,685,889 candidates, wey represent 93.39% get dia results fully processed and released while 119,327 candidates, wey represent 6.61% get one or more of dia subjects still dey processed.

Dis na sake of some issues wey we dem dey resolve, WAEC tok.

“Efforts dey go on to sharpaly release di results within days, di exam bodi add.

Analysis of statistics of candidates performance for di exam show say out of di 1,805,216 candidates wey sidon for di exam, 1,332,089 candidates, wey represent 73.79%, gbab credit and above for minimum of any five subjects.

Dis na wit or witout English Language and/ or Mathematics.

1,301,941 candidates, wey represent 72.12%, gbab credits and above for minimum of five (5) subjects, including English Language and Mathematics.

Of dis number, 628,820 wey be 48.30% be male candidates, 673,121 wey be 51.70% na female candidates.

Dis year record 7.69% decrease for performance if we compare am to last year.

Dat na to say dose wey gbab credit and above for minimum of five subjects, including English Language and Mathematics, be 79.81% den.

Di results of 215,267 candidates, wey represent 11.92% of di total number of candidates dey withheld sake of connect wit different reported cases of exam malpractice. Dis na 4.37% lower dan di 16.29% wey dey recorded for di WASSCE for School Candidates, 2023.

Wetin to do if your results no open for Waec result checker?

If your waec result no open for di website e fit mean two tins.

Di first one, e fit be internet connection issue or na sake of high traffic for di result checking site.

Di advice na to wait small and check again.

If you don try all dis e still no work den you go need to contact [email protected] for verification and assistance, or you visit di nearest WAEC office for further enquirers.

Wetin to do if your waec result display outstanding or you no see your result?

If your result display outstanding you fit trace am to various issues.

Just kotinu to check di portal for updates on outstanding results.

For di case of no result afta you don fill in your details well, just check back at intervals becos dem fit update di website or you visit di nearest WAEC office for assistance.

How to correct gender from female to male for waec result

If your gender no correct for di waec result dis na how you fit correct am.

To correct di error u go need to visit WAEC office to clear dat issue wey happun by mistake during di registration process.

How many times wey I fit check my results and I fit use one e-PIN to check more dan one result?

You fit check your result up to a maximum of 5 (five) times wit di use of 1 (one) e-PIN. If you check pass fives times you go need to buy another e-PIN wey you go dey entitled to anoda 5 (five) result checks.

Na waec national office you fit by di Electronic PIN and for any of dia Zonal and Branch Offices across Nigeria.

Di price for di e-PIN na N1,500.

You only fit use one e-PIN Voucher to check one result. To check anoda result of interest, you need to get new e-PIN Voucher.

If you misuse your e-PIN Voucher by attempting to check anoda result different from di first one wey you don check bifor, waec go penalise you.

If you buy result checker e-PIN Voucher a year bifor, e still dey valid for use for di next year but know say na once you fit use one e-PIN Voucher to check one result. To check a (different) result, you go need a new e-PIN Voucher.

I check my WAEC result wit di center and Examination number but I see any pesin result?

Waec say dem dey use di same examination numbers every year but di only unique difference na di examination year.

Dem advise candidate to change di exam year to di year wey dem take di exam.

To check again, di candidate go need to buy a new waec checker e-PIN Voucher to do am.

WAEC officials dey mark candidates scripts?

No be WAEC dey mark students examination paper, na examiners WAEC dey appoint to mark di scripts.

So who be dis examiners?

Dis examiners na sabi pipo for di education sector wey know classroom work well-well.

To ensure say mago-mago no dey for di grading system, WAEC dey set up committee of experts wey go come up wit di marking guide.

Na dem go drill all di appointed examiners well-well on all aspects of di marking scheme for one marking exercise wey dem dey call co-ordination.

Even wen di actual marking start, dem no dey leave di examiners on dia own.

Dem dey organise dem into small groups, each of dem go dey supervised by one highly experienced examiner wey be di Team Leader.

Na di Team Leader dey check and vet di group members marking progressively to make sure say dem dey follow di guidelines.

Di Team Leaders demsefs dey supervised by more experienced examiners wey dem dey call Chief Examiners.

Wen dem don mark finish, WAEC go still employ anoda group of pipo - dem dey call dose ones Checkers.

Di main role of Checkers na to make sure say all di marks wey di examiners give dem record am correctly and dem transfer am to di right score sheets.

WAEC no dey reveal di identity of di examiners wey dem dey use to mark di exam papers.