P Diddy dey accused of swinging woman from high balcony inside new case against am

Wia dis foto come from, Reuters
- Author, Samantha Granville
- Role, BBC News, Los Angeles
- Read am in 3 mins
Sean “Diddy” Combs dey face accuse for one new lawsuit of hanging one woman from di 17th-floor balcony for one apartment wen dem quarrel.
Na fashion designer Bryana "Bana" Bongolan file di lawsuit for Los Angeles as she allege say di incident happun for 2016 while she she bin dey for Oga Combs house wit im girlfriend dat time Casandra "Cassie" Ventura.
Dis na di latest for more dan two dozen lawsuits wey accuse Oga Combs of several offences, including sexual assault, drugging pipo, threatening witnesses and causing physical harm.
Di music mogul dey also face federal charges for racketeering and sex trafficking scheme. Im don deny all di allegations, including dis latest claim.
One of im representative tell BBC on Tuesday say im "firmly deny dis serious allegations" for di new lawsuit and im "dey confident say ultimately dem go prove say dem dey baseless".
Madam Bongolan say she bin dey spend di night for Madam Ventura apartment wen Oga Combs start to shout and bang on di front door, di lawsuit tok.
Afta im come inside di house, Oga Combs allegedly confront Madam Bongolan, wey bin dey di balcony dat time. Di lawsuit state say im allegedly grab and molest her.
Im come lift her up and start to swing her from di balcony of di unit, di lawsuit allege.
As of di time of di incident, Madam Bongolan bin dey weigh about 100lb (45.3 kg), according to di lawsuit.
E claim say Madam Bongolan bin "attempt to resist am, so she throw her weight back in a desperate struggle to avoid am to throw her to di ground and likely to her death", but Oga Combs "easily overpower her".
Di lawsuit state say Madam Ventura come outside back to intervene, and Oga Combs allegedly pull Madam Bongolan back ova di ledge by slamming her on top di balcony furniture.
One representative for di rapper deny di allegations for statement to BBC on Tuesday.
"Anybody get right to file a lawsuit, regardless of di evidence dem fit or fit no get," di statement read, adding say Oga Combs "get strong faith for di facts and for di fairness of di judicial process".
E continue: "For court, di truth go come out, demonstrating say di claims against Oga Combs no fit hold water."
Madam Bongolan claim say she no know and still no know wetin bin provoke di alleged incident, according to di suit. She dey seek $10m (£7.89m) in damages from di rapper.
For di lawsuit, Madam Bongolan allege say na "coming togeda of a series of threats, intimidation and violence wey colour many of Madam Bongolan interactions wit Oga Combs from di day she meet am".
Dis allegations resemble di incident wey dey ground for a separate lawsuit filed by Madam Ventura against Oga Combs.
Dat lawsuit - na 2023 dem file and dem settle one day afta - alleged abuse, rape and sex trafficking. E note one episode for Madam Ventura apartment wen Oga Combs bin "pick up one of Madam Ventura friends like a child and swing di friend ova di balcony".
Madam Bongolan also allege say she endure "terror and abuse" from Combs throughout dia professional relationship, wey begin wen di music mogul bin approach her to collaborate on projects like clothing line and album cover art.
Oga Combs dey prison for Metropolitan Detention Center for Brooklyn, New York, afta one judge bin deny am bail three times.










