Jay-Z dey accused with Diddy inside lawsuit of raping 13 years old girl in 2000

Wia dis foto come from, Getty Images
- Author, Jude Sheerin
- Role, BBC News, Washington DC
- Read am in 4 mins
American rapper Jay-Z don hit back at one lawsuit wey allege say e, along wit Sean "Diddy" Combs, bin drug and rape one 13-year-old girl for one party for year 2000.
Di anonymous accuser bin allege say she bin dey assaulted for one house party afta di MTV Video Music Awards (VMAs) wey happun for New York and say one unnamed female celebrity bin dey di room dat time.
For statement, Jay-Z, wey im real name be Shawn Carter, dismiss di legal action as "blackmail attempt".
Oga Combs – wey bin dey jail dey await trial afta e dey charged for September wit sex-trafficking and oda offences – bin deny di latest accusation.
Di lawsuit bin originally dey filed for October, and dem refile am on Sunday to list Oga Carter as defendant.
Di BBC don contact Oga Carter lawyer, Alex Spiro, and im publicist for comment.
Di legal action dey filed under New York Victims of Gender-Motivated Violence Protection Act, by one Texas-based lawyer, Tony Buzbee.
Oga Buzbee don file plenti lawsuits in recent months to accuse Oga Combs of assault and rape. Di hip-hop artist dey due to face one criminal trial on 5 May.
Oga Carter tok for statement wey dey posted to social media: "My lawyer receive one blackmail attempt, wey dem call demand letter, from one 'lawyer' wey dem name Tony Buzbee.
"Wetin e don calculate na di nature of dis allegations and di public scrutiny go make me wan settle.
"No sir, e get di opposite effect! e make me wan expose you for di fraud wey you be in a VERY public fashion. So no, I no go give you ONE RED PENNY!!"
One statement from Oga Combs legal team tok say dis amended lawsuit na di latest in a series of "shameless publicity stunts, wey dey designed to extract payments from celebrities wey dey fear say make dem no spread lies about dem, just as lies don dey spread about Oga Combs".
Di statement tok say di judicial process go show say Oga Combs dey innocent of all di allegations against am. E dey face 30 oda lawsuits.
Di accuser for one Sunday legal filing, wey dey identified only as "Jane Doe", tok say for year 2000, wen she be 13, one friend bin drop her off for di VMAs for Radio City Music Hall for Manhattan.
She bin approach di limousine drivers outside di venue to try to gain access to di show, according to di legal action.
One driver bin tell her say she dey employed by Oga Combs and say she "fit wetin Diddy dey look for", di lawsuit tok.
Later dat evening, di chauffeur bin drive her to one party for one white house, according to di legal action.

Wia dis foto come from, Getty Images
Jane Doe tok say wen she bin land for di party, dem bin ask her to sign one document, wey she believe say na one non-disclosure agreement, di lawsuit tok.
Di legal action say she bin sabi "many celebrities" for di party and observe widespread drug use, including cocaine.
One waitress offer her drink wey bin make her feel "woozy", so she bin go inside one room to lie down, according to di lawsuit.
Soon afterwards, di legal action say, Oga Combs and Oga Carter bin enter di room wit one female celebrity, wey dem describe as Celebrity B. "Plaintiff immediately recognize all three celebrities," say di lawsuit.
Di legal action say Oga Combs bin approach her "wit one crazed look for im eyes", grab her and say: "You are ready to party!"
Oga Carter bin hold her down and rape her, bifor Oga Combs do di same, all di while Celebrity B bin watch, according to di lawsuit.
Jane Doe bin fight back during di assault and wen Oga Combs bin back away in surprise she escape, di legal action tok.
Di lawsuit, wey dey try seek unspecified damages, say di plaintiff still dey suffer from post-traumatic stress disorder and depression sake of di alleged rapes.
For im statement, Oga Carter, wey dey married to Beyoncé, wit whom e get three children, say: "My only heartbreak na for my family.
"My wife and I go need to sit our children down, one of wey dey di age wia her friends go surely see di press and ask questions about di nature of dis claims, and explain di cruelty and greed of pipo."









