Luigi Mangione charged wit murder, wetin we know about United Healthcare CEO shooting suspect

Dis foto wey dem take from social media show Luigi Mangione

Wia dis foto come from, Instagram

    • Author, Madeline Halpert & Mike Wendling
    • Role, BBC News
  • Read am in 6 mins

Profile don dey come out of di 26-year-old man wey authorities charge wit murder over last week deadly shooting of United Healthcare chief executive, Brian Thompson, for New York City.

Police announce on Monday say dem don arrest Luigi Mangione on firearms charges afta dem recognise am for one McDonald for Altoona, Pennsylvania.

Dem find di Baltimore, Maryland, indigene in possession of a so-called ghost gun, one firearm, and a three-page handwritten document wey show "motivation and mindset", officials tok.

Just hours afta im arrest, investigators for New York charge Mangione wit murder and four oda counts.

Dis na wetin we don gather so far about di suspect.

Dem born Mr Mangione and raise am for Maryland and e get tie to San Francisco, California, according to New York Chief of Detectives Joseph Kenny.

Dem never arrest am before for New York and im last previous address na for Honolulu, Hawaii, police tok.

E attend private, all-boys high school for Baltimore, wey dem call di Gilman School, according to school officials. Mr Mangione na di valedictorian, wey usually be di student with di highest academic achievements inside class.

Inside statement, di school call di situation "deeply distressing".

A former classmate, Freddie Leatherbury, tell Associated Press news agency say Mr Mangione come from a wealthy family, even by di private school standards.

"Quite honestly, everything dey go for am," Mr Leatherbury tok.

Wetin we call dis Video, Watch: Luigi Mangione land for Pennsylvania courthouse

Oga Mangione come from a prominent family for di Baltimore area wey dia businesses include a country club and nursing homes, according to local media.

Shortly afta dem charge di suspect, Republican state lawmaker Nino Mangione - wey e dey believed to be im cousin - release statement say di family dey "shocked and devastated".

"We offer our prayers to di family of Brian Thompson and we ask pipo to pray for all involved", di statement tok, dem sign am off as "The Mangione Family".

Mangione na also a graduate of di University of Pennsylvania, wia e receive a Bachelors and Masters degree in computer science, according to di school, and e be di founder of a video game development club.

Im friend wey attend di Ivy League college at di same time as Mangione describe am as a "super normal" and "smart person".

Mangione bin dey employed as a data engineer for TrueCar, one digital retailing website for new and used cars, according to im social media profiles. One of di company spokesman tell BBC say e stop to dey work dia since 2023.

According to im LinkedIn profile, Mangione work bifor as a programming intern for Firaxis, wey be video game developer.

Man in a blue shirt dey look camera

Wia dis foto come from, PA Department of Corrections

Wetin we call dis foto, Police release dis mugshot of Mangione afta dem charge am wit murder

Dem arrest Mr Mangione for one McDonald's afta one customer inform one employee, wey alert di authorities.

At di time, e bin dey wit a black ghost gun - di type wey dem fit assemble for house wit 3D printer - a silencer and a loaded magazine wit six rounds of 9mm ammunition.

Police say e carry several IDs, including one wit im real identity and anoda wey be fake.

Di IDs include a US passport and a fake New Jersey ID wey dem use to check into di New York City hostel, wia dem see di suspect bifor di shooting.

Wen dem tell am say dem go arrest am if e lie about im name, e admit say e be Luigi Mangione.

Ween dem ask am why e lie, e tell officers say "I no suppose to", according to court papers.

E "become quiet and start to shake" when dem ask am if e recently go New York, according to di criminal complaint dem file for Pennsylvania.

Police say dem find am with three pages of handwritten documents where e be like e express "bad belle towards corporate America".

Di document also say "Dis parasites had it coming" and "I apologise for any problem and trauma, but it had to be done", one senior law enforcement official tell di New York Times.

Police said although im arrest dey "peaceful", e don since stop to dey cooperate.

Luigi Mangione charged wit murder of healthcare CEO for New York

Authorities for US don charge 26 year old Luigi Mangione wit murder of healthcare CEO Brian Thompson for New York City.

Oga Mangione bin appear for Pennsylvania court on Monday wia dem charge am wit possession of an unlicensed firearm and oda charges.

Dem handcuff am for im wrists and ankles and im bin look calm during di hearing, occasionally im go look around for those wey dey present, including di media.

Just hours later, New York investigators charged am wit murder and four oda counts including firearms charges.

Last week's shooting triggered a huge manhunt, with New York City investigators using one of the world's largest digital surveillance systems as well as police dogs, drones and divers in a Central Park lake to search for the attacker.

Wetin im social media profiles tell us?

Social media profiles provide some possible clues about wetin Mr Mangione bin dey think.

One person wey match im name and photo get account on Goodreads, a user-generated book review site, where e give four stars to one text called Industrial Society and Its Future by Theodore Kaczynski – wey also dey known as the Unabomber manifesto.

Starting in 1978, Kaczynski carry out a bombing campaign wey kill three people and injure plenty others, until dem arrest am for 1996.

For im review, Mr Mangione write: "E dey easy to quickly and thoughtless[ly] write dis off as mad man manifesto.

"E be violent individual - wey dey rightfully imprisoned - wey maim innocent people.

"While dis actions tend to dey characterized as di ones of a mad person - luddite -(person wey dey opposed to new technology), however, dem dey more accurately seen as actions of extreme political revolutionary."

Im social media profiles also suggest say e don fall out of touch with family and friends in recent months.

Inside one post on X from October, someone tag account believed to be Mr Mangione and write:

"Hey, you dey ok? Nobody don hear from you in months, and your family dey look for you."