Video of how di New York shooting of UnitedHealthcare CEO happun

Wetin we call dis Video, Watch: What we know about the shooting of UnitedHealthcare CEO
Read am in 5 mins

Di police don offer $10,000 (£7,800) reward for anyone wey help find wia di suspect wey shoot Brian Thompson, healthcare CEO for New York dey.

Also, police drones, helicopters, dogs and thousands of CCTV cameras dey comb di city street by street in an effort to trace di suspect.

New York City Police Commissioner Jessica Tisch tok for news conference say: "Evri indication na dat dis na attack wey dey targeted, planned and carried out."

Di suspect wey dey wear a black face mask and cream jacket, appear to dey wait for Thompson for five minutes outside di hotel, police say.

Di suspect also dey captured on a surveillance camera minutes bifor di shooting at a Starbucks less dan two blocks away.

Wen Thompson arrive alone on foot for di Hilton hotel, di shooter step on to di pavement from behind a car and shoot am for back.

Investigators say dem no know di motive of di suspect, wey runaway from di scene witout taking any of di victim belongings.

United States police authorities dey on a man-hunt for New York City after di head of US insurance company UnitedHealthcare dey shot and killed inside wetin police call a "targeted attack".

Brian Thompson bin dey shot in di back and leg about 6:45 EST (11:45 GMT) on Wednesday outside di Hilton hotel in Midtown Manhattan.

One suspect, wey carry grey backpack, run from di scene and dem last see am ontop e-bike for Central Park, di New York Police Department tok.

Thompson, head of di largest private insurer for di United States, dey live for Minnesota and bin dey New York to speak for one investor conference later in di day.

Screengrab of Brian Thompson and CCTV footage of di suspect

Wia dis foto come from, CCTV/ UnitedHealthcare

Di 51-year-old die for a nearby hospital, wia dem rush am for treatment. Police describe di incident as "targeted attack."

Police say di suspect dey wait for Thompson outside and run comot from di scene wearing a ski mask,

Di suspect, wey carry backpack, run comot di scene ontop e-bike in Central Park.

Police say di suspect na a light-skinned male, wey wear grey backpack, a light brown or cream-colored jacket, a white face mask and black-and-white sneakers.

E land di scene five minutes before Thompson, and target am specifically, ignoring oda pedestrians nearby.

After shooting Thompson once, di gun jam. Di suspect clear di jam and shoot again. E run comot on foot and later climb one electric city bike wey e ride into Central Park.

Who be di suspect?

CCTV image of suspect

Wia dis foto come from, NYPD News

Di New York City Police Department don share pictures, on X, of di suspect for di shooting of Brian Thompson.

Di two pictures appear to be screengrabs from CCTV footage from outside one Hilton hotel for Midtown Manhattan.

Di crime scene for Midtown Manhattan

Wia dis foto come from, Reuters

Who be Brian Thompson?

Foto of Brian Thompson

Wia dis foto come from, UnitedHealthcare

Thompson na di leader of UnitedHealthcare, di largest private insurer for US.

Dem name Thompson as di chief executive of UnitedHealthcare for April 2021. E make $10.2m (£8m) working for di company last year.

Di 50-year-old start for di health insurance provider for 2004, and e don hold multiple leadership roles, including CEO of di company government programs division.

E graduate from di University of Iowa for 1997 with a bachelors degree in Business Administration, according to im LinkedIn profile.

Wetin be UnitedHealthcare?

Foto of UnitedHealthcare office, New York.

Wia dis foto come from, EPA

UnitedHealthcare, America largest health insurance firm, na subsidiary of UnitedHealth Group, e dey operate among doctors, hospice networks and surgical centres, manage prescription drug benefits programmes, and work closely wit goment health insurance such as Medicare and Medicaid.

Dem dey regularly accuse di company of refusing to pay for valid medical care, claims wey don lead to legal action and settlements for some states. Regulators don also sue di firm ova proposed acquisitions, alleging say dia hold on di industry dey too great.

Earlier dis year, di firm cause anger as di target of one hack, wey cause financial palava for medical practices across di kontri and cause accusations say di company don fail to put adequate cyber security practices in place.

Di controversies no affect di business. Ahead of im investor day, di firm dey forecast double digit revenue growth and profits of roughly 10% next year.

UnitedHealthcare na di largest health care company by revenue for di US, based in Minnetonka, Minnesota.

Dem found di parent company, UnitedHealth group, for di 1970s. In 2023, di company net earnings na $22.3bn.

UnitedHealthcare na di largest provider of Medicare health insurance plan in di kontri. E also manage health insurance for companies, as well as state-funded and federally fund Medicare.

Di company dey employ around 440,000 pipo worldwide.