At least four pipo die inside shooting for one 16-year-old birthday party for US

Dadeville shooting scene

Wia dis foto come from, Getty Images

At least four pipo don die for one mass shooting for di US state of Alabama on Saturday.

Plenti pipo injure afta di incident for one 16th birthday party for di city of Dadeville, local media dey report am.

Di shooting happun around 22:30 (03:30 GMT) on Saturday.

"Dis morning, I grieve wit di people of Dadeville and my fellow Alabamians," state Govnor Kay Ivey tok.

"Violent crime no get any place in our state, and we dey stay closely updated by law enforcement as details dey comot," di govnor add for one statement on Twitter.

Di Alabama incident follow one shooting on di same day for one park for Louisville, Kentucky, wey kill two pipo and injure four odas.

Di govnor na strong supporter of second amendment rights - di right to keep and bear arms - and last year she sign legislation wey cancel di requirement for Alabama to get permit to carry handgun wey dem hide for public.

Na di National Rifle Association endorse her candidacy for last year govnor election.

Victim of shooting na star athlete - Family

Phil Dowdell

Wia dis foto come from, Twitter @philstavious

Local media don name Phil Dowdell as one of di victims of Saturday night shooting.

Phil na senior for high school and im dey attend Jacksonville State University on American football scholarship.

Pastor Ben Hayes, wey serve as di chaplain for di Dadeville Police Department and for di local high school football team, say most of di victims na teenagers.

"One of di young men dem kill na one of our star athletes and just a great guy," im tok.

"I sabi many of dis students. Dadeville na small town and dis go affect everybody for di area."

Im grandmother Annette Allen tell di Montgomery Advisor say, “im be very, very humble child. E no dey ever mess with anybody. Always get a smile on im face,"

Officials neva confam Dowdell death.

Allen tell di outlet say di party wey di gunfire tear apart na to celebrate di 16th birthday of Dowdell sister, Alexis.

Di Montgomery Advertiser report say dem also shoot Dowdell mama and she injure.

Dem don organise community vigil for di victims of Saturday shooting.

E neva get any confirmation about wetin lead to di incident, or weda dem don take any suspects into custody.

Di Alabama incident follow one shooting on di same day for one park for Louisville, Kentucky, wey kill two pipo and injure four odas.

With a population of about 3,200 pipo, Dadeville na small, rural town wey dey located for Tallapoosa County for di east of Alabama.

Na more dan 140 mass shootings don happun for US so far dis year.

Alabama map