Tributes pour in for Song Jae Rim, Korean actor wey die at 39

Wia dis foto come from, Getty Images
One Korean actor wey dem dey call Song Jae Rim don dey confirmed dead at di age of 39.
Tori be say im friend find am dead by noon on Tuesday for im house as dem both suppose go for lunch.
Many of im co-stars don comot for social media page to mourn im death.
Im fellow actor and television personality, Hong Seok Cheon, write for im social media page say, "I dey sad say I no go eva see your wonderful smile again... Rest in Peace". Bifor im come write for im stories say, "I love you, I miss you and I am sorry my brother".
Reports say local Seoul police tok say dem bin find note for im house but dem still dey investigate wetin cause of death.
Di 39-year-old actor wey bin dey known for im role for di hit Kdrama, The Moon That Embraces The Sun, bin dey inside two new dramas dem release dis year, My Military Valentine and Queen Woo.
Local tori pipo, YTN tok say im new representative wey dem dey call Manager A afta e comot im old agency last year bin reveal say im don already act inside three new projects wey dem neva even release.
Anoda actor Kim Min Kyo put di sad focus on how Korean actors just dey die for im tribute wen im tok say, "Jae Rim, just a month ago, you bin dey tell my wit very bright voice say you bin dey perform. So why? How come? I go bury anoda star for my heart. I go remember you forever."
Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of Instagram post
Di actor bin reveal for one Instagram post say im start im career for front of camera for 2009.
Some of im highlights for fans, na wen e act inside di music video of di Kpop group 2NE1, di 2014 reality show, We got Married Season four wey im do wit Boys Over Flowers actress, Kim So Eun.
E also run di 2016 drama, Our Gap Soon wit di same actress.
Anoda actress wey follow act for Our Gap Soon, Yoo Sun also mourn im death say, "Jaerim, e pain me well, well. I hope say you go fit finally rest".
E bin also act for di hit 2010 drama, Secret Garden wit star actors, Ha Ji Won and Hyun Bin.
Anoda actor Park Ho San for im own tribute apologise to Jae Rim say e no protect am.
Tori be say Jae Rim bin dey involved in stage play a month to im death and even im fake wife from We got married, Kim So Eun bin take out time to support am for di project.
According to im social media for threads, even wen im stop to dey post for im Instagram, e still mostly continue to dey post about im old cat, Leon for di page.
Several Korean stars don die for 2024 wey include model, Shin Hae ri at di age of 32, and Singer Park Bo ram wey die at di age of 30.









