Wetin we know about di death of Parasite actor, Lee Sun-Kyun at di age of 48

South Korean actor Lee Sun-kyun

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, South Korean actor Lee Sun-kyun

Authorities don confam to BBC say dem find South Korean actor, Lee Sun-Kyun dead.

Di actor wey be 48 years old bin dey popular for im role inside di Oscar winning feem, Parasite.

Dem find di actor unconscious inside motor for one of di main parks for Seoul on Wednesday.

E neva clear weda na oga Lee take im own life but police say im comot house afta im write one note.

E don dey under investigation since October say im dey use drugs.

Tori pipo Yonhap tok say e bin dey suspected say e dey take drugs like marijuana and ketamine for one hostess bar for Seoul. But e tok say e just take wetin di hostess bin give am and e no know say na illegal drugs.

Di hostess bin tell police say e don dey take di drugs for im house plenti times, but e say na lie. E bin even ask through im lawyers make dem do lie detector test on am.

Police say dem dey sad say im die for di middle of di investigation but na with im consent dem bin dey run am na wetin News 1 Korea tok.

Di agency wey oga Lee bin dey, HODU&U Entertainment tok for statement say, "way no dey to fit carry our sorrow, We dey ask una respectfully make una no spread fake news, dey speculate... so im final journey no go dey unfair."

Di tori of im death dey trend online.

One comment for di tori say, "I no fit reason how e go don hard for am. Rest in Peace."

Anoda commenter tok say, "celebs no be human being dem be? Pipo dey do mistake for dia lives. So sad!"

Who be Lee Sun-Kyun

Lee Sun-Kyun don dey di Korean drama space for ova 20 years. E marry fellow actress Jeon Hye-Jin and togeda dem don born two boys.]

E bin act for plenti feems and TV shows like Coffee Prince and na like dat e blow for di 2010s among pipo wey gbadun Korean entertainment conent.

But e blow worldwide for di feem Parasite wia im act as Park Dong-Ik di papa of di rich family wia poor family dey follow gum bodi.

For di 2020 Oscars, di movie gbab four awards wey include best picture. Na di first non-English feem wey go gbab di award.

For South Korea, dem dey reason celebrities as if dem no suppose do bad tin.

Di image oga Lee bin get before dis accusation of drug use na of pesin wey be family man.

Tori be say dis investigation spoil im reputation as dem comot am from one mystery TV series "No Way Out" wey start shooting for October.

More reports say business dem dey comot posters and adverts wey get oga Lee from dia store.

Drug crimes wey include marijuana na serious offence for South Korea. Di crimes get prison time of up to five years.

South Korea Presido Yoon Suk Yeol don promise to crackdown on drugs.

In fact no be only oga Lee, get case to ansa on drug use.

Early dis month, Kpop star G-Dragon bin dey cleared of drug accuse afta weeks of investigation.

Also actor Yoo Ah-In dey stand trial for drug use.