Who don join Trump team so far?

Wia dis foto come from, Getty Images
Di new team wey go try deliver Donald Trump agenda don dey come togeda. Dis na as di list get plenti controversial pipo for im proposed administration.
Bifor im go enta White House on 20 January 2025, di president elect bin name Pete Hegseth, a Fox News host and military veteran, as im pick for defence secretary and e want make Robert F Kennedy Jr be im health secretary.
Marco Rubio go be di next secretary of state and billionaire Elon Musk go work for cost cutting.
Dis na a closer look at di posts wey im don name replacement for and di names dem dey call for di top jobs wey neva dey filled.
We go start with di cabinet roles, wey need approval from US Senate.

Deputy chief of staff - Stephen Miller

Wia dis foto come from, Getty Images
Stephen Miller don be Trump close adviser and speechwriter since 2015. E be Trump choice for White House deputy chief of staff for policy.
Tori be say na im go arrange any plans for mass deportations and reduce both undocumented and legal immigration.
For Trump first term, na im get hand for some of di admistration strictest immigration policies.
Commerce secretary - Howard Lutnick

Wia dis foto come from, Reuters
Howard Lutnick di co-chair of Turmp transition team and CEO of one financial company, Cantor Fitzgerald na who be di pick for di Commerce department.
Trump tok say Lutnick go ginger di administration "tarriff and track agenda.
Lutnick bin also dey in di running for treasury secretary wey be a more high profile role.
Energy secretary - Chris Wright

Wia dis foto come from, Getty Images
Oil and gas industry executive Chris Wright go lead di Department of Energy, wia e dey expected to fulfil Trump campaign promise to "drill, baby, drill" and maximise US energy production.
Wright na di CEO and founder of Liberty Energy, wey call climate activists say dem be alarmist and say Democrats push to renewable be like Soviet-style communism.
For video wey dem post for im LinkedIn profile last year, "no climate crisis dey, and we no dey di middle of any energy transition too".
White House counsel - William McGinley
Republican lawyer William McGinley go take di role according to Trump.
E tok for statement say, "Bill dey smart and e be tenacious lawyer wey go help me advance our America First agenda as e dey fight for election integrity and against di weaponization of law enforcement."
Transportation secretary - Sean Duffy

Wia dis foto come from, Getty Images
Former congressman and Fox Business host Sean Duffy na who bin dey chosen to lead di Department of Transportation.
If senators confam am, e go dey in charge of aviation, automotive, rail, transit, and oda transportation policies for di transport department wey dey get about $110bn budget yearly.
For di role, di incoming secretary go face some safety related aviation wahala wey alreadi dey ground. Dis include di kasala for Boeing wia dem dey face series of safety and quality issues.
Veterans affairs - Doug Collins

Wia dis foto come from, Getty Images
Former congressman from Georgia, Doug Collins na im dey chosen to lead di US Department for Veterans Affairs.
Collins na Trump guy wen e serve for Congress from 2013-21. E bin tok in favour of di president-elect, di two times wey dem hold impeachment hearing for am.
E be Iraq war veteran wey now dey work as chaplain for di US Air Force Reserves.
Collin bin comot Congress afta e bin try enta senate unsuccessfully for im home state for Georgia.
Communications Director – Steven Cheung
Steven Cheung bin join Trump campaign for 2016 as im campaign tok-tok pesin. Soon e go take one top communication role for di white house.
Na Chinese immigrant parents raise am for California. And Cheung bin start im career as intern under di den Carlifornia Govnor Arnold Schwarzenegger. E don also work as tok-tok pesin for di Ultimate Fighting Championship (UFC).
Cheung gain popularity on top di kain way im dey take yab Trump opponents. E bin tok say Joe Biden “dey slowly waka about like say im get full diapers inside im trouser”. E also tok say Florida Govnor Ron DeSantis dey waka like girl wey “just find out about koi-koi shoe for di first time”.
For im first term in office, Trump bin get ogbonge turnover of communications directors, na six pipo bin do di job. Sotay Anthony Scaramucci bin only spend 11 days for di work.
Assistant to di president – Sergio Gor
Sergio Gor na di business partner of Trump pikin, Donald Jr. E be di president and co-founder of Trump publishing company wey dem dey call winning Team Publishing. Di company na im publish one book wey di president-elect bin write.
Trump tok for statement say “Steven Cheung and Sergio Gor don be trusted advisers since my first presidential campaigns for 2016 and don continue to dey ginger for American First principles.”
Office of Management and Budget - Russell Vought

Wia dis foto come from, Getty Images
Russell Vought dey selected for di Office of Management and Budget, wey be role wey im bin hold for Trump first term.
Di agency dey help craft di president budget, work as di central regulatory gatekeeper and make di president agenda work across goment.
E also write one key chapter for Project 2025 - we be 900 conservative wish-list wey wan expand di power of presidency.
Trump tok about am say, "e do well for di first term wey im serve for dis role. We bin cut four regulations for evri new regulations and na great success."
Labour secretary - Lori Chavez-DeRemer

Wia dis foto come from, Getty Images
Lori Chavez-DeRemer na di pick for di department wey dey oversee, worker health and safety, workforce laws and dey give unemployment and workers compensation.
She bin dey for Congress since 2023 but lose re-election bid for Oregon for November.
Housing secretary - Scott Turner
Scott Turner na NFL veteran and motivational speaker wey dey chosen to lead di department in charge of American housing needs, wey dey enforce law and prevent discrimination and also provide low income housing for pipo in need.
Turner bin serve as di executive director of di White House Opportunity and Revitalization Council for Trump first term.
Agriculture secretary - Brooke Rollins
Brooke Rollins na di co-founder and oga of di America First Policy Institute, a Maga-backed think tank.
For Trump first term, she work as di director of di Office of American Innovation and acting director of di Domestic Policy Council.
Director of national intelligence - Tulsi Gabbard
Trump name Tulsi Gabbardwey be former Democratic congresswoman from Hawaii as Director of national intelligence.
Di former US Army Reserve bin run for president for Democrat for 2020 but don turn Republican in recent years. She even dey Trump transition team now.

Wia dis foto come from, Getty Images
Special envoy to the Middle East - Steve Witkoff
Steve Witkoff na real estate investor wey Trump pick for di role.
Trump say na "highly respected leader in business and philanthropy wey dey make evri project and community wey e dey to dey stronger and more prosperous."
US ambassador to Israel - Mike Huckabee
Former Arkansas Governor Mike Huckabee na pro-Israel official and Trump say e wan end di kasala for di middle east.
For Trump statement e say, "Mike na great public servant, govnor and leader in faith for many years."
Ambassador to Nato - Matthew Whitaker
Former acting Attorney General Matthew Whitaker na Trump pick for Nato wey Trump don tok say im wan comot bifor.
Trump tok say, "Matt go strengthen relationship wit our Nato Allies and stand firm for di face of threats to Peace and Stability. E go put Nato first."
Federal Communications Commission chair - Brendan Carr
Brendan Carr na current member of the Federal Communications Commission (FCC), wey dey regulate broadcast and internet use.
Trump don promise bifor say im go comot licence of TV channels wey e tink say dey biased.
Education secretary - Linda McMahon

Wia dis foto come from, Getty Images
Linda McMahon na long-time Trump ally wey bin lead di Small Business Administration during Trump first presidency and donate millions of dollars to im presidential campaign.
She bin dey appointed as education secretary as im tok sat she go "spearhead di effort to send education back to di states."
McMahon wey also be Trump transition co-chair go dey expected to handle di education sector for di United States.
McMahon get a long history wit di WWE and Trump dey make occasional appearances during wrestling matches.
She co-found Titan Sports wit her husband for 1980 wey later become di parent company of WWE years later.
She resign as CEO for 2009 so she go fit undertake a failed bid to run for di US Senate.
Medicaid - Mehmet Oz

Wia dis foto come from, Getty Images
Trump also choose Mehmet Oz, wey be celebrity doctor and former TV host wey im approach don come under serious tok to lead di Centers for Medicare and Medicaid Services (CMS).
Oz wey be 64 years na trained cardiothoracic surgeon wey specialise for operations on di heart and lungs – and work for di New York City Presbyterian Hospital and Columbia University.
Oz wey dey selected to lead di CMS dey trained as a surgeon bifor finding fame for Di Oprah Winfrey Show for di early 2000s.
Oz don dey criticised by experts for promoting wetin dem call bad health advice about weight loss drugs and "miracle" cures, and suggestion of malaria drugs as a cure for Covid-19 for di early days of di pandemic.
National secuity adviser - Mike Waltz

Wia dis foto come from, Reuters
President-elect Donald Trump select Florida congressman Michael Waltz as di next national security adviser.
Di national security adviser dey advise di president on various threats to US and Waltz go likely get to help navigate di US position on di wars for Israel, and for Ukraine and Russia.
E dey considered to be influential role and no require Senate confirmation.
Border tsar - Tom Homan

Wia dis foto come from, Reuters
Dis na ogbonge job because e include responsibility for Trump mass deportations of millions of undocumented migrants, wey be a central campaign pledge.
Trump make di announcement on Truth Social, calling Homan a "stalwart" on border control.
Di former police officer be acting director of di US Immigration and Customs Enforcement (Ice) for Trump first term and e don advocate for a zero-tolerance stance on di issue.
“Trump dey come back in January, I go dey on im heels coming back," e tok for July. "And I go run di biggest deportation force dis country don ever see."

Department of Govment Efficiency - Elon Musk & Vivek Ramaswamy

Wia dis foto come from, Getty Images
Billionaire entrepreneur Elon Musk, di world richest man, don dey named to lead wetin Trump don call di Department of Govment Efficiency alongside one-time presidential hopeful Vivek Ramaswamy.
Di department - wey dem sabi as "Doge" in reference to one cryptocurrency wey Musk bin promote - go serve for one advisory capacity to "dismantle govment bureaucracy, slash excess regulations, cut wasteful expenditures and restructure federal agencies, Trump tok for statement.
According to Trump, di department go provide "guidance" and work closely wit di White House and Office of Management and Budget.
While department heads need to dey confirmed by di Senate, e no clear which approval process go dey necessary for dis roles.
United Nations ambassador - Elise Stefanik

Wia dis foto come from, Reuters
Media reports - wey dey confirmed by BBC US partner CBS News - say di New York congresswoman don dey offered di UN ambassador job.
Stefanik don make national headlines with her sharp questioning for congressional committees, first for Trump 2019 impeachment hearings and again dis year quizzing college leaders about anti-semitism on campus.
For im statement to di New York Post, Trump describe her as "an incredibly strong, tough, and smart America First fighter".ugh, and smart America First fighter," Trump said in a statement to the New York Post.
Certain political appointments for di US - including di UN ambassador job - require di approval of di US Senate. But Trump don demand say make di next Senate leader let am make appointments without traditional confirmation votes.
Stefanik become di youngest woman eva wey dey elected to Congress for 2014, wen she be 30. She continue to represent New York 21st District.
Head of Enviornmental Protection Agency - Lee Zeldin

Wia dis foto come from, Getty Images
Lee Zeldin, a former New York congressman, don agree to lead di Environmental Protection Agency, both im and Trump tok. Di Senate go still need to confirm im appointment.
E go dey in charge of tackling America climate policy for dis role.
"We go restore US energy dominance, revitalize our auto industry to bring back American jobs, and make US di global leader of AI," Zeldin tok for statement on X, formerly Twitter. "We go do so while protecting access to clean air and water."
Zeldin don for long be Trump pady-pady - and e be one of 126 Republican members of Congress wey sign onto a brief to di Supreme Court wey contest di 2020 election results.
While serving in congress from 2015 to 2023, Zeldin vote against expanding a number of environmental policies. E don already say e plan to "roll back regulations" from day one.
E never earn high marks from environmental groups for im voting record on environmental issues.
Chief of staff - Susie Wiles

Wia dis foto come from, Getty Images
Susie Wiles and campaign co-chair Chris LaCivita be di masterminds behind Trump victory over Kamala Harris.
For im victory speech, Trump call her "the ice maiden" - as e refer to her composure - and say she like to stay in di background. Wiles be di first appointment for Trump top team.
Di chief of staff na most times di president top aide, overseeing daily operations for di West Wing and managing di boss staff.
Wiles, 67, don work inside Republican politics for years, from Ronald Reagan successful 1980 presidential campaign to electing Rick Scott and Ron DeSantis as governors of Florida.
Republicans don say she command respect and get di ability to manage di big egos of those for Trump orbit, wey fit enable her to impose a sense of order wey none of im four previous chiefs of staff fit do.
Attorney General - Pam Bondi

Wia dis foto come from, Reuters
Trump first pick for attorney general, former Florida Congressman Matt Gaetz comot imself from consideration for di work on Thursday. Dis na afta a week of kasala on top one congressional investigation into am into sexual misconduct and drug allegations.
Gaetz deny all di claims but tok say im wan avoid "needlessly protracted Washington scuffle."
Afta six hours wey Gaetz withdraw, Trump name Pam Bondi wey be former Florida attorney general for di work.
E tok for statement say "Pam bin dey work as prosecutor for almost 20 years wia she bin dey tough on Violent Criminals and bin make di streets safe for Florida families."
Bondi bin serve for Trump first administration as member of di Opioid and Drug Commision. And she bin dey di defence team during im first impeachment trial.
Secretary of State - Marco Rubio

Wia dis foto come from, Getty Images
Di US secretary of state na di president main adviser on foreign affairs, and dey act as America top diplomat wen representing di country overseas.
Florida Senator Marco Rubio na who Trump pick for di position.
Rubio, 53, get a hawkish view of China. E oppose Trump for di 2016 Republican primary but don since settle with am. E be a senior member of di Senate foreign relations committee and vice-chairman of di chamber select intelligence panel.
Intelligence/national security posts

Wia dis foto come from, Getty Images
Trump don choose im former director of national intelligence, John Ratcliffe, to serve as Central Intelligence Agency director.
Trump bin tok for im statement say di ex-Texas congressman "don always be a warrior for Truth and Honesty wit di American Public".
E get oda yet-to-be-appointed key positions running intelligence agencies, including the FBI and director of national intelligence.
Trump don tok say e go fire FBI Director Chris Wray, wey e bin nominate for 2017, but since don fall out wit. Jeffrey Jensen, one former Trump-appointed US attorney, since don dey under consideration to replace Wray.
Defence secretary Pete Hegseth

Wia dis foto come from, Reuters
Pete Hegseth don dey nominated to be di next defence secretary for di new Trump administration.
Di army veteran also na Fox News host and former head of two advocacy groups for military veterans. Bifor, e bin run unsuccessfully for Senate seat for Minnesota.
"Pete dey tough, smart and a true believer in America First," Trump bin write for one statement. "Wit Pete for di helm, America enemies dey on notice - Our Military go dey Great Again, and America no go Ever Back Down."
Im appointment na one of di most highly anticipated for Trump cabinet as di wars in Ukraine and Gaza dey go on.
"Nobody dey fight harder for di Troops and Pete go be a courageous and patriotic champion of our 'Peace through Strength' policy," Trump tok.
Homeland security - Kristi Noem

Wia dis foto come from, Getty Images
South Dakota Governor Kristi Noem don dey nominated for di key role to dey oversee US security, including im borders, cyber-threats, terrorism and emergency response.
Di agency get one $62bn (£48bn) budget and employ thousands of pipo. E dey incorporate one wide variety of agencies under im umbrella, from Customs and Border Protection and di Federal Emergency Management Agency to di Coast Guard and Secret Service.
For her new position, Noem go work closely with Tom Homan, wey dem name border tsar, and Stephen Miller, wey dey in charge of policy, to deliver on Trump immigration pledges.
Dem pass Noem over to be Trump running mate afta she tok how she bin kill her pet dog.
Bifor her election as South Dakota governor for 2018, di 52-year-old Noem bin serve as US Representative in Congress for eight years and for di state House of Representatives for four.
Treasury secretary - Scott Bessent

Wia dis foto come from, Getty Images
Scott Bessent, wey be billionaire hedge fund manager wey don become a major fundraiser and economic adviser to di president-elect don dey nominated for di to lead di US Treasury Department.
Di post get wide oversight of tax policy, public debt, international finance and sanctions.
Tumpt tok say, "E don be strong advocate fr di America First Agenda for long. E go support my policies wey go drive US competitiveness and stop unfair trade imbalances."
Department of di interior - Doug Burgum

Wia dis foto come from, Getty Images
Trump announce for speech for Mar-a-lago say e go ask Doug Burgum wey be di govnor of North Dakota to lead di Department of di Interior.
A software entrepreneur wey sell im small company to Microsoft for 2001, Burgum briefly run for di 2024 Republican primary before dropping out, endorsing Trump and quickly impressing am with im low-drama persona and sizeable wealth.
If dem confam am, Burgum go oversee di agency wey dey responsible for management and conservation of federal lands and natural resources.
Press secretary - Karoline Leavitt

Wia dis foto come from, Reuters
Karoline Leavitt, 27, wey impress Trump as im campaign national press secretary, don already serve as assistant White House press secretary and fit be di administration spokesperson.









