How Donald Trump win Kamala Harris to make a historic return to di White House

Democratic supporters react to Kamala Harris result for Washington DC

Wia dis foto come from, Reuters

Read am in 3 mins

Donald Trump don win a historic second term as president afta defeating Kamala Harris.

Na di projected win for Wisconsin bin push di Republican ova di 270 electoral vote expectation wey dey required to win di presidency.

Harris bin pick up states for di north east, di west coast, as well as Colorado and Illinois meanwhile, Trump win di battleground states of North Carolina, Georgia, Wisconsin and Pennsylvania to make am di next US president.

Donald Trump bin win North Carolina and Georgia and don also take lead over Kamala Harris in most of di oda five battleground states wey go decide winner of di US election, BBC US partner CBS project.

Trump don address im supporters but Harris neva come out to address her own supporters.

Anoda key moment na wen di Senate dey called for di Republicans wey mean say di Democrats go lose dia strong majority for di upper chamber of di US Congress.

Breakdown of how pipo vote

We don also get anoda batch of exit poll data, wey shed light on di divide between men and women in tdis election.

Not surprisingly, a majority of women support Kamala Harris, while men dey give dia support to Donald Trump.

Wetin dey surprising small be say, at least according to dis findings, na say di 54% of women wey vote for Harris no match di 57% wey bin support Joe Biden in 2020.