Una bye-bye!
Na here we go march break for our live coverage of di US election today.
You fit scroll down to see how di election don waka so far.
Una thank you and bye bye!
Both Trump and Harris don chart dia own historic and difficult paths to election day.
Helen Oyibo, Faith Oshoko, Annette Arotiba, Victor Ezeama and Adebola Ajayi
Na here we go march break for our live coverage of di US election today.
You fit scroll down to see how di election don waka so far.
Una thank you and bye bye!
In case you just dey join us, dis na wetin don happun so far on election day.

Wia dis foto come from, US Pool
Kamala Harris running mate Tim Walz bin meet wit voters for Pennsylvania.
E tell tori tori pipo as e dey enta plane to Washington DC say, "we're feeling good about dis".
Di Minnesota governor dey stick close to di campaign message by drawing a contrast between di Harris campaign - wey e tok say dey based on hope and unity - and Trumps message wey e say im find to dey dark and divisive.
E give reassurances about im faith for di democratic process, e say US get di "freest, most secure elections". E note, however, e fit take some time to get results.
Walz do one final round of radio interviews dis morning. E encourage listeners for Detroit, Milwaukee, North Carolina, Atlanta and Philadelphia to go di polls and vote for Harris.
FBI agents don arrest two pipo for Michigan on top accuse say dem make election-related threats, according to The Detroit News.
Di Michigan-based outlet say dem arrest one suspect wey dey linked to one assassination plot wey target Donald Trump.
Di man, Isaac Sissel, allegedly post on Reddit under di username "ShootUpTrumpRally" and e tell investigators say im believe "everything go better if Trump die".
For di second criminal case dem reveal on Tuesday, Christopher Clay Pierce, 46, of Jackson bin dey accused of threats against one unidentified political action committee (PAC) affiliated wit di Democrats ova di past two years.
FBI bin don warn Pierce say dem fit charge am wit crime if e continue to post threats online, but e continue to harass di Democratic-aligned group.

Wia dis foto come from, reut
Georgia Secretary of State Brad Raffensperger say di bomb threats wey dem make against multiple polling places dis morning no dey credible.
E tok for press conference, say di threats get Russian origin. E add say "we catch dem evri time" and say dia plan na to "scata America".
Earlier, we report say five separate threats na im dem make for polling locations for Fulton County.
Dem evacuate two stations but all of dem don reopen and voting continue.
Florida dey among di 10 US states wey dey vote on abortion access.
Voters dey vote on weda to comot di six week abortion ban wey dey ground and to increase di access till di time of foetal visibility wey dey about 24 weeks of pregnancy.
Dem ask Donald Trump how e vote for di issue wen im cast im ballot and e ansa say, "just stop to dey tok about dat".
Dis na just to show how e don dey struggle wit di mata of abortion. For August, Trump bin face backlash from conservatives wen e be like say e support di ballot and di very next day, e tok say e go vote against am.
Im opponent Kamala Harris also dodge question wey dem ask am for her home state of California on top how she go vote for ballot measure wey go increase sentence for some drug and theft crimes.
She say, "I no go tok about di vote bicos honestly na di Sunday bifor di election and I no need to create endorsement anyhow."
For one tradition wey go back to 1960, di tiny resort town of Dixville Notch, New Hampshire, na di first place for di kontri to vote on election day.
Dia six residents cast their ballots for midnight local time (0500 GMT), and di outcome dey announced 15 minutes later - and e give us our first vote tally of di race.
For a race wey dey so competitive, di town evenly split 3-3 between Donald Trump and Kamala Harris.
Kamala Harris dey ask Americans to “get out and vote” for radio interviews today.
"We need to do am. Today na voting day, and pipo need to get out and be active," she tok on Atlanta station WVEE-FM.
Wen dem ask her about how her presidency fit make history on The Big Tigger Morning Show for Georgia, Harris say she bin dey focused on di "task wey dey my front" and in making sure say she dey "respond to di needs of folks around di policies," according to BBC US partner CBS News.
Harris agree say she go be di first HBCU (historically black colleges and universities) president, as she note say di first office she ever run for na freshman class representative for Howard University.
She say going back to Howard to host her election night party later today go be "full circle" moment.
Harris also tell Pittsburgh-based radio show, The Big K Morning Show wit Larry Richert, say bifor di party, she go DO dinner wit her family, she note say many relatives dey stay wit her.
Voting do begin for Hawaii by pass 07:00 wey be di final state to open dia polling booths wey mean voting dey go on all ova di US now.
Hawaii wey get four electoral votes go be one of di last states wey go close polls for 19:00 local time. Some parts of Alaska go stay open one hour later.

Wia dis foto come from, EPA-EFE/REX/Shutterstock
Dem don record five non-credible bomb threats for polling locations for Fulton County, Georgia, dis morning, according to CBS, wey be BBC US media partner.
Nadine Williams, wey be di county director of registration and elections, say di threats make dem do temporary evacuations for two locations wey last about 30 minutes each for di swing state.
Di county wey include di city of Atlanta now dey work to get court order to extend voting for di two affected locations.

As America dey vote, all eyes dey for di swing states wey dey expected to decide di election.
For presidential elections, states wey get more pipo dey worth more points or electoral college votes as dem dey call dem.
For di whole of di US, dem get 538 electoral college votes.
Di winner go be who get 270 electoral votes or more.
Di seven states wem dey call key states for dis election get 93 electoral votes combined.

Wia dis foto come from, Reuters
Donald Trump and im wife Melania don vote finish for di Mandel Recreation Centre for Palm Beach, Florida.
Wit im trademark red cap, e follow tori pipo tok.
E say "I feel very confident ... and e be like Republicans don comot wit force."
Trump say e dey "honoured" to see say di lines dey pretty long.
E tok say, "I hear say we dey do very well."
E tok say dem return from im campaign rally from Michigan late last night.
Tori of technical wahala for Cambria County don come from voters as Pennsylvania dey continue to vote.
Di tori be say scanners no dey work. One local woman Jessenia Anderson tok say, "pipo dey vote and leave dia ballots either facing down or dem go put dem for luck box wey dey under di scanner".
Oda pipo don comot to tok similar tin for X wey dem bin call Twitter bifor.
For statement, di Cambria County Board of Election tok say na "software malfunction" no allow some pipo to scan dia ballots.
Di board don file court order to increase di tome to vote for di county.
Dem don also report dis kain mata for Allegheny County wey include Pittsburgh. For at least two cases, di county tok say electoral officials delay ot enta di designated polling places.
Ten million voters go enta ballot booths across di United States for Tuesday.
But di result of di elections, wey include who go be di next president, no go dey official until votes dey counted and verified wey fit take days to finish.
Di first polls go start to close as early as 18:00 EST (23:00 GMT) for some counties on Tuesday but counting of votes go pass dat time by hours for most states.
For two battleground states, Pennsylvania and Wisconsin, election workers no dey allowed to start to process mail in ballots till election day. Dat one dey expected to slow counting.
E dey important to remember say tori pipo go use unofficial results and projection wen dem announce winners for election night or in di next few days, instead of to wait for di official count to finish.
Some counties dey "feed" ballots for optical scanners, while odas dey use touch-screen systems or ballot-marking device to take record votes.
Di scanners na di most common way. Dem dey tabulate results wey go dey manually recounted and dem go double-check am wit hand.
07:00 don nack for Alaska and 08:00 for Washington state wey mean say all polling stations don dey open.
Na three electoral college votes dey for Alaska, wey be America largest state by land. And Washington get 12 electoral college votes as dem be di lumber producer of di US.
Hawaii wey get four electoral college votes go be di last US state wey open dia polling booths for 07:00 local time.
And to sabi how big America be, and different time zones for di kontri. Voting for Hawaii dey start just seven hours bifor di first polls go close for di East Coast.

One polling location for Buncombe County, North Carolina na one of di areas wey dey most affected by di end of September by Hurricane Helene.
As dem no get plenti time to respond, di state election officials put "festival tents" wey dem use generator to power for dia and six oda locations for di region.
Rain still dey fall for di polling area dis Tuesday even as trucks still dey park doti comot from road for di area.
Amanda Lambert wey be event staff member wey dey monitor di polling site joke say "na wetin we need be dis, more rain."
Even though e still dey slow, Lilian Govus, Buncombe County communication director estimate say western North Carolina go break dia total vote turnout record of 78% wey dem bin set for 2020.
US intelligence agencies don tok say, "Russian influence actors" dey behind one fake video alleging election fraud for Arizona.
Di video wey one now suspended pro-Kremlin account for X bin post don dey viewed ova 200,000 times.
E show one man wey dem no name wey claim say e be former aid to Arizona Secretary of State Adrian Fontes wey allege say e bin see evidence of "ogbonge fraud against Donald Trump".
Fontes don tok say di claims na lie.
Di man face for di video bin dey pixelated and im voice - wey sound monotonous, get pauses wey no dey natural - get all di habits wey dey consistent wit AI-generated audio.
Di video bin dey produced by di Russian Foundation to Battle Injustice (“FBI”) wey dey set up of 2021 by di late oligarch Yevgeny Prigozhin. Bifor im die dem don alreadi sanction am for US for election interference.
Di joinbodi content dey normally dey boosted by di Russian influence operation 'Storm-1516' wey dey linked to plenti suspected election fakes.

Wia dis foto come from, Russian Foundation to Battle Injustice
Polls don officially open for California, Idaho, Nevada and Oregon.
Di only states wey voting neva start now na for Alaska and Hawaii.
California get 54 electoral votes - di most of any state for di US.
Nevada, wey get six electoral votes, na di last of di seven swing states to open polls today.
Rules for voter registration dey different from state to state but for large parts of America, time neva finish for voters to register even though today na voting day.
Almost half of di states wey include di District of Columbia agree for same-day registration on election day but di rules dey different according to states.
For di oda states, di deadline don pass except North Dakota wey no dey ask for registration.

Na windy morning for di polling station for West Palm Beach wia Donald Trump go soon land wit im wife Melania to vote.
Normal voters dey enta and comot as cameras plenti and tori pipo wey don gada to catch di former president for camera dey ground. E dey expected say e go come vote and tok small later.
Group of employees from di Palm Beach Public school don siddon for di wall wit US flags dey wait and most of dem dey hala dia support for oga Trump loudly.
One of dem na teacher wey dem dey call Brooke Kennedy - she say US don dey di "wrong path" for di last four years.
She tok say she don already vote for Donald Trump bicos na im match her "biblical world view". Dis na reminder say amendment of weda to comot di state strict abortion ban dey for di ballot.