Ooni of Ife stand wit im ex-wife Queen Naomi afta deadly Ibadan stampede

Wia dis foto come from, ooniadimulaife/Instagram, queen_silekunolanaomi_ogunwusi's profile picture queen_silekunolanaomi_ogunwusi/Instagram
Tributes don dey pour in for victims of di Ibadan children funfair tragedy wey claim di lives of 35 children and leave several odas injured.
On Wednesday 18 December, tragedy bin knock for Ibadan, Oyo state southwest Nigeria wen one event wey suppose be celebration party for children turn deadly sake of stampede.
Nigeria President Bola Tinubu don pay condolence to di family of those wey lost dia loved ones.
For statement, Oga Tinubu say make relevant authorities investigate wetin cause di incident. E also say e dey important to know weda na negligence or deliberate actions contribute to wetin happun, and make dem ensure say di investigation dey transparent.
"Our children safety and well-being remain paramount. No event suppose compromise dia safety or take precedence ova dia lives."
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
Police arrest ex-Ife Queen and oda organisers

Wia dis foto come from, Queen Naomi Ogunwusi/Instagram
Di Oyo State Police Command say dem don gbab Olori Naomi Ogunwusi and odas sake of di tragedy wey happun for one children event for Ibadan.
For statement on Thursday 19 December, di police tok say na 35 pipo bin die for di stampede wey shele for di Islamic High School, Basorun, di venue of di family event wey Wings Foundation and Media partner Agidigbo FM, bin organise.
"So far thirty-five minors don dey documented to don die while six odas dey critically injured and on various medical interventions," di statement tok.
Apart from di ex-Queen wey be di main sponsor of di event, seven odas including di school principal also dey police custody.
Di police say dem don transfer di case to di Homicide Section of di State Criminal Investigation Department, Iyaganku and add say na di Deputy Commissioner of Police in charge dey lead di investigations.

Meanwhile, di Oyo state Govnor Seyi Makinde wey also confam di incident for statement tok say di event wey happun for Islamic High School, Bashorun for Ibadan, Oyo State, south-west Nigeria na for families, "sadly stampede occur for di venue wey lead to multiple loss of lives and injuries".
"We don deploy security agents to restore order for di venue. We also don deploy medical personnel and ambulances to di venue. We don stop di event and escort attendees out of di venue. We dey take all realistic measures to ensure say di venue dey secured," Govnor Makinde tok.
"Our hearts remain wit di families and loved ones wey dis tragedy impact. May di souls of di departed rest in peace. Amen."

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2
Ooni plus oda ogbonge Nigerians mourn victims of Ibadan stampede
Di Ooni of Ife, don send condolence message to di families of di victims of Ibadan stampede, wey claim di lives of dozens of children on Wednesday and wunjure several odas.
For statement wey di palace release, Oba Adeyeye Ogunwusi, promise to support all efforts wey go bring peace and healing to dos wey dey affected by dis ogbonge loss.
''We share for di grief and pains wey di affected families dey face. We pray make Olodumare grant dem di fortitude to bear for dis trying time.'' Oba Adeyeye Ogunwusi tok.
Oba Adeyeye Ogunwusi show support to im ex-wife wey be one of di organisers of di event.
Di Yoruba king say Naomi bin dey do dis kain event for Ile Ife as Queen, to help children for dat area evri December.
Im encourage her not to dey discouraged to do dis kain programmes for children but to get beta plan and strategies of execution for di future.
Oba Adeyeye Ogunwusi advise pipo wey wan do events like dis to follow safety standards and child welfare policies for educational institutions while im call for immediate actions to prevent dis kain unfortunate incidents for future.
Ogbonge pipo for di kontri don also dey express dia condolence and tok sorry to di families of di pipo wey lose dia loved ones.
One former Nigerian Senate President Bukola Saraki, former vice-president, Atiku Abubakar dey among dos wey react to di incident. Dem call for thorough investigation by authorities to ensure accountability and say make such incidents no ever happun again.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 3
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 4
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 5
Di Wings Foundation wey organise di event advertise am as free, and dis draw plenty crowd, so many pipo turn up and stampede happun as dem dey try gain entry to di venue.
Residents tok say ova 5,000 children bin gada for di venue and di stampede happun wen di main organisers begin dey land di event venue.
Oyo State goment tok say dem don carry victims go different hospitals across Ibadan for treatment afta di stampede.
BBC Pidgin follow di tok-tok pesin for UCH Ibadan, Funmi Adetuyibi, tok and she confam say dem bring five children come di hospital and dem don die bifor dem come di hospital.
Wetin we know about di event
Di organiser of di event, Queen Naomi Ogunwusi, say na her foundation, one Non-Governmental Organisation - Women In Need Of Guidance and Support bin host am and dem tag am "Children Fun-fair 2024 and di purpose na to celebrate children and to have fun.
Di celebration dey hold evri year, and dem don host am for different states bifor.
For one programme on Agidigbo FM, ahead of di event, di former Queen bin tok say she ready to host 5000 kids between di age of 0 and 13 years across Ibadan for free under di egis of (WINGS) foundation.
She say di event wey dey scheduled for Wednesday, 18 December dey strictly for children. She add say dem go win exciting prices like scholarships plus oda bountiful gifts.
Olori Ogunwusi bin also assure parents and guardians of adequate security for all participants of di event.
But wetin neva dey clear na if adequate security measures and medical provision dey in place for di children as she tok.
Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of Instagram post










