Baba Ijesha case update: Actor Omiyinka Olanrewaju collect bail for alleged defilement trial for Lagos

Court don grant bail to Nollywood actor Baba Ijesha wey bin dey face trial.
Omiyinka Olanrewaju [wey be Baba Ijesha real name] dey accused of sexual assault.
Im plead say e no dey guilty of di charges against am for alleged defilement of minor.
One Ikeja court inside Lagos, Nigeria commercial capital na im grant Baba Ijesha.
Di bail condition include of two million Naira wit two sureties.
Di judge rule say di actor must meet di bail conditions in seven days.
For di conditions: Im must provide one lawyer, plus pesin wey dey stay for Lagos.
Dat pesins gatz be im blood relation as im sureties.
End of Di one wey oda users dey read well well
Lagos state government establish criminal case against Olanrewaju James, recommend am to face five-count charge
On June 16 a Yaba Chief Magistrate Court bin deny Baba Ijesha bail request for dis case.
For Thursday case, Babatunde Ogala SAN na di lead lawyer wey represent Baba Ijesha.
Ogala tanda along with Dada Awosika SAN and Kayode Olabinrin plus odas.
In all, over 15 lawyers appear for Ijesha on Thursday morning.
Di prosecution na DPP, ministry of Justice dey lead di case for goment lawyers.
Afta plenty tok-tok, di court adjourn di case until di 26, 27 and 28 of July.

Baba Ijesha case - Wetin fit happun for court today
So wetin go happun for court on Thursday 24 June, for case wey get public interest?
Last week di Yaba Magistrate court for Lagos extend di actor detention period.
E order di Nollywood actor to stay for police cell till 13 July, 2021.
Di actor lawyer tell BBC Pidgin say dem believe court go free di actor.
Unto say dem believe di actor dey innocent of di case against am, di lawyer add.
E still dey possible say court fit sama am anoda heavy bail condition wey go had am to meet.
Last time judicial authorities grant am bail, e no meet all di bail conditions.

Some of dem dey very hard for am to meet.
Anoda tin wey fit happun be say court fit remand Di actor for prison or police cell.
Dis fit happun while di case go dey go on.
Though im case dey bail-able according to commissioner of police for Lagos.
But im case no be di first bailable offense wey court don remand di suspect for prison.

Wia dis foto come from, @OLOFOFOMUSIC
Di Yaba court no gree Nollywood actor bail becos authorities don carry di case go high court.
Baba Ijesha don dey detention for over two months.
Di alleged case na di biggest sexual offense case for Nigeria for di past two months.
Na sake of say many concerned Nigerians chook mouth, while some do protest for di matter.

Baba Ijesha court trial: Actor Omiyinka Olanrewaju go face dis charges
Lagos Attorney General and Commissioner Moyosore Onigbanjo tok for statement say:
Police bin forward di case to di Directorate of Public Prosecutions [DPP] for legal advise.
DPP recommend Baba Ijesha to face five provisions of di 2015 Criminal Law of Lagos State.
Dis provisions include:
1. Section 135, Indecent Treatment of a child - wey dey punishable by 7 years imprisonment
2. Section 137, Defilement of a Child, wey dey punishable by life imprisonment
3. Section 261, Sexual Assault by Penetration - e dey punishable by life imprisonment
4. Section 262, Attempted Sexual Assault by Penetration - wey dey punishable by 14 years imprisonment and
5. Section 263, Sexual Assault - wey dey punishable by 3 years imprisonment














