Baba Ijesha case update: Princess react as Nollywood actor Olarenwaju James get bail

Wia dis foto come from, INSTAGRAM
Nigerian comedienne plus actress Damilola Adekoya wey many pipo sabi as Princess don tok afta court grant Olarenwaju James AKA Baba Ijesha bail.
Di actor tok say she go win, if e no be now but e sure for am say she go definitely win.
Princess post for her Instagram page say she go win, if no be now, but later.
Princess post dey come afta lawyer to di nollywood actor actor Baba Ijesha confirm to BBC Pidgin say dem grant di actor bail.
Barrister Adeshina Ogulana wey be lawyer to di actor say magistrate wey dey do prison decongestion free di actor on Monday evening.
E never clear wetin be di next step ontop di case.
Di Police arrest Baba Ijesha ontop alleged sexual assault case on a minor few weeks ago.
Princess bin accuse di Yoruba nollywood actor, Baba Ijesha say im sexually molest her foster teenage daughter.
Police for Lagos state bin arrest di popular actor wey im real name na Olarenwaju James about two weeks ago on top accuse say e allegedly defile di 14 years old girl.
Police PRO, Muyiwa Adejobi tok for statement say CCTV allegedly capture di 48 years actor as e dey carri out di act for di house of victim.
Police say di actor don dey allegedly defile di girl since di age of seven, from wetin dem find out and dem don begin do dia own investigate.
Di arrest cos plenti tok tok for social media as some pipo dey demand for di release on bail of di actor, while some dey demand make dem still lock am.
Di mata even cause disagreement among some of Baba Ijesha colleagues.

!["Baba Ijesha arrested": [Nollywood actor Olarenwaju James] chop arrest for rape](https://ichef.bbci.co.uk/ace/ws/660/cpsprodpb/F40B/production/_118157426_babaijeshaarrested-nollywoodactorolarenwajujameschoparrestforrape.jpg.webp)







