Authorities deboard Social media influencers VDM and Mr Jollof afta dem 'exchange blow' inside plane

Collage of VDM and Mr Jollof

Wia dis foto come from, OTHERS

Read am in 4 mins

Di United Nigeria Airlines don confam one fight wey hapun onboard dia aircraft between social media personality Matins Otse wey pipo sabi as Very Dark Man (VDM) and one comedian Freedom Atsepoyi alias Mr Jollof on Monday, 17 November.

Di confirmation dey come afta one video wey go viral show di two social media influencers dey fight for inside di aircraft.

Tok-tok pesin for di airline Chibuike Uloka for statement explain say di kasala hapun during di boarding of flight UN0523 for Asaba International Airport on Monday morning.

E say to ensure di safety of di oda passengers, dem immediately remove di two fighting from di plane and dem give airport security for investigation.

"In full compliance wit global aviation safety protocols, our crew bin respond immediately and professionally to de-escalate di situation. Dem de-board both passengers without delay to ensure di safety, comfort and security of all oda passengers and crew members."

Uloka add say di two passengers still dey wit di authorities, as di aircraft fly wit di oda passengers.

Wetin cause di kasala between VDM and Mr Jollof neva dey clear but di Nigeria Civil Aviation Authority (NCAA) don tok say dem go torchlight am.

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post, 1

Di video wey don go viral for social media now, show di two social media influencers dey fight inside plane.

Pipo fit hear as VDM tok say im go slap pesin come down from di plane. Di video show as e near Mr Jollof, bifor di fight escalate between di two of dem. You fit hear pipo dey shout "VDM, VDM, Pls, make una hold dat guy now," inside di plane.

Dis dia fight don generate plenty tok-tok for social media, as e dey come few months afta di Nigerian Civil Aviation Authority, NCAA, ban popular Nigeria fuji star Wasiu Ayinde alias K1 De Ultimate from flying for six months sake of one airline kasala, but dem later lift di ban and turn am to aviation ambassador.

Also for August, di Airline Operators of Nigeria bin place one female passenger, Comfort Emmanson, wey get altercation wit airline officials on top one Ibom Air flight, on a 'No Fly' list till further notice, but dem later lift di ban, afta investigations and intervwntions.

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post, 2

As wetin cause di fight between VDM and Mr Jollof neva still dey clear, di Director, Public Affairs & Consumer Protection for NCAA, Michael Achimugu for im initial reaction tok say no mata wetin lead to di fight, no excuse go make am dey acceptable.

Oga Achimugu for one post on X tok say, di aviation body go investigate di mata and di two of dem go face di law.

"No tolerance dey for dia unruly behaviour aboard an aircraft. Both individuals go face di full strength of di law. E dey even more shameful wen one consider both of dem partners in educating dia millions of followers to avoid unruly behaviour," e tok.

E say im go give full details about di position of NCAA soon.

Meanwhile, fighting or oda disorderly conduct for inside plane or for di terminal building na offence according to aviation rules and regulations and according to di rules, physical assault or threat to physically assault on individual wey no be crewmember na - Minimum to maximum civil penalty and/or criminal referral.

United Nigeria Airlines

Wia dis foto come from, United Nigeria Airlines/X