Aviation sector saga: Comfort Bob regain freedom, Kwam 1 na airport ambassador as ValuJet pilot license dey restored

Comfort Bob, Ibom Air passenger
Read am in 5 mins

One Ikeja Magistrate Court for Ogba, Lagos State Nigeria don discharge Comfort Emmanson Bob, di Ibom Air passenger wey di airline accuse of unruly behavior including assault and breaking of parts of dia aircraft.

Ms Bob leave di court room at about 2:00pm on Wednesday afternoon afta spending two days for kirikiri prison.

One of her lawyers Adefunke Adewale tell BBC News Pidgin say her discharge na unconditional release.

Magistrate Olanrewaju Salami strike out di case based on say di prosecution team send letter to di court say dem dey withdraw all di five count charges against Ms Bob.

Her lawyer Adams Atakpa tell court say dem no get objection to di new development.

Police bin arraign Bob on Monday for court on top five count charges wey include alleged assault and other offences.

Court grant am bail dat day to di sum of N500,000, wit two sureties in like sum, dem remand am for Kirikiri Correctional Centre as she no fit meet her bail conditions dat day.

Wen di case resume on Wednesday, di prosecution lead Oluwabunmi Adeitan tell court say new development dey di mata wey make dem withdraw di case.

E say di police don get new facts about di case afta di Monday sitting, say na dis make di commissioner of police decide to withdraw di case unconditionally.

‎For her ruling, di Magistrate say she dey satisfied wit wetin di two counsels agree and strike out di case.

She advise Ms Bob to always display wisdom for future no mata di way dem take annoy am.

Kwam 1 na airport ambassador as ValueJet pilot license dey restored

Wasiu Ayinde Marshall

Meanwhile, Nigeria aviation minister Festus Keyamo for statement earlier on Wednesday tok say di Ibom air passenger Bob dey remorseful and dem go process her release from di prison.

According to di aviation minister, e say e don meet wit plenti stakeholders for di aviation sector ontop di mata wey don hapun for di last 48hours.

Keyamo say all di parties wey dey involved for di airports incidents don learn dia lessons in regrettable manner.

Di minister also torchlight di case wey involve popular Nigerian Fuji musician Wasiu Ayinde Marshall alias K1 De Ultimate and ValueJet.

Wen dat case hapun wia K1 De Ultimate bin try block ValueJet airline from flying, di Nigeria Civil Aviation Authority (NCAA) bin alert federal authorities to prosecute am and dem place di musician for 'no fly list'.

Di Aviation minister say she don follow Ibom Airline tok say make dem withdraw di charges against her, as she show remorse for her conduct wen dem take her statement for di presence of her lawyer.

"For di case of di unruly passenger, Ms. Comfort Emmanson, on di Ibom Airline on Sunday 10 of August, 2025, I don confer wit Ibom Airline to withdraw di complaint against her today."

Keyamo say if di complainant withdraw di complaints against Emmanson, "di CP of Airport Command and di Police Prosecutor go immediately take di remaining steps to facilitate her release from Kirikiri Prisons within dis week."

Dem also lift di life-ban wey di Airline Operators of Nigeria (AON) bin sama her bifor, and dem go make am public.

"I don confer wit di leadership of di Airline Operators of Nigeria (AON) and don appeal to dem to lift di life-time flying ban wey dem impose on her, wey dem agree."

Di case of ValueJet and Kwam 1

As for di case of Kwam 1 wey dem place for 'no fly list' sake of im kwanta wit di ValueJet officials.

"For di case of KWAM 1, di NCAA go reduce im flight ban to one-month period."

"FAAN go also work wit di music star wit view to engage am as ambassador for proper airport security protocol going forward."

Di minister say di NCAA go also withdraw dia criminal complaints against KWAM 1 wey dem earlier lodge wit di Police.

Dem go restore di license of di ValueJet pilot and co-pilot, but dem go undergo some re-appraisal.

"For di case of Captain Oluranti Ogoyi, and di co-pilot, First Officer Ivan Oloba of ValueJet, di NCAA go restore dia licenses afta di same period of one-month ban afta dem undergo some mandatory professional re-appraisal."

Wat next for FG afta di airport incidents

Di case of K1 De Ultimate wit ValueJet and Emmanson wit Ibom don make airport authorities begin dey cut ears for passengers make dem obey airport rules and regulations.

Afta dis case, di federal goment say dem go collaborate wit agencies and do retreat to properly retrain security personnel for Aviation.

"I don direct all relevant Aviation agencies in collaboration wit oda complementary agencies outside aviation to immediately begin retreat next week so dem go properly retrain and prepare our Aviation security personnel on how to deal wit troublesome passengers"

Di Aviation minister say di airlines go do dia own session wia dem go focus on di conduct of dia staff.

Minister Keyamo say all di decisions wey dem take na on 'compassionate ground' and e no dey politically motivated.

Skip Instagram post
Allow Instagram content?

Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of Instagram post