Authorities keep Comfort Bob for Kirikiri, charge her on five counts including alleged assault

Wia dis foto come from, Ibom Air/X and screenshot
Authorities for Nigeria don charge di passenger, Comfort Emmanson wey chop accuse say she assault airline officials on top Ibom Air Flight go court and she dey custody for Kirikiri Correctional Centre for Lagos.
Aviation Minister Festus Keyamo confam am for statement for im X account say dem charge Emmanson also known as Comfort Bob on five counts of criminal charges including assault and as she no fit provide sureties, dem remand her for prison.
Di minister say Police bin arraign Emmanson on Monday morning for di Ikeja Magistrates Court for criminal offences and remand her for Kirikiri Prisons as she bin o fit provide adequate sureties for court.
Meanwhile, di minister also note say di Nigeria Civil Aviation Authority (NCAA) don ban impose an indefinite flight ban on Emmanson, (both local and international).
Di charges wey reach five include alleged assault.
Comfort wey be di accused passenger never release comment on di allegations wey dem don sama for her head.
Earlier, Ibom Air bin release one statement say dem ban Emmanson from flying dia airline on top accuse say she allegedly assault cabin crew members and security officers during her flight from Uyo to Lagos on Sunday, 10 August.
Ibom Airline tok say di passenger wey dem identify as Ms Comfort Emmanson no behave well and "pose threat serious threat to di crew, passengers, and aircraft while travelling on board from Uyo-Lagos."
Di airline tok say dem don submit dia report to Nigerian Civil Aviation Authority (NCAA) and place travel restriction on her.
"Ibom Air don submit report on di incident to di Nigerian Civil Aviation Authority, and place travel restriction on Ms. Emmanson, go no longer dey permitted to fly on any of our aircraft," di statement tok.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
'Staff wey release di indecent video must face sanction'
Some clips from di video wey go viral of di drama wey hapun between di passenger and airline staff and ground staff show di passenger Comfort Bob in indecent state.
As officials bin dey try drag her down from di plane, her blouse tear and her breasts bin dey exposed. Dat clip don dey shared widely ontop social media. Di minister condemn am.
"While we support di filming of her recalcitrant behaviour as evidence to prosecute her, wetin dey deplorable na to release such evidence containing indecent exposure to di public to ridicule her. E dey totally unacceptable to us.
We no go fold our arms and tolerate di debasing of womanhood. I don therefore direct say make dem single out whoever release dat part of di video containing di indecent exposure among di staff and adequately sanction am."
Di minister also direct make di airlines continue to train and retrain dia staff in public relations and how to deal wit potentially explosive situations in order to stop dem immediately.
How di mata hapun
Ibom Air tok say afta cabin crew instruct passenger make dem switch off dia phones in line wit aviation safety procedure wen dem wan depart from Uyo, but Ms Emmanson refuse, den anoda passenger snatch her phone to switch am off.
Ibom Airline claim say wen dem arrive for Lagos airport, Ms Emmanson den confront di purser wey instruct passengers make dem switch off dia phone wen di airplane wan depart from Uyo.
"Ibom Air don confam say on Sunday, August 10, 2025, one incident occur on board our Uyo–Lagos flight involving one passenger, Ms Comfort Emmanson, her conduct pose serious threat to di safety of our crew, passengers, and aircraft," di statement tok.
"Shortly bifor take-off from Uyo, dem give Ms Emmanson instruction in line wit standard aviation safety procedures, to switch off her mobile phone. She refuse to comply, afta which one fellow passenger, wey seat beside her take di phone and switch am off."
"Dis action prompt verbal trade from Ms Emmanson. Di situation eventually calm, and di flight depart as scheduled."
Di airline allege say she physically attack di purser and forcibly comot di wig wey dey her head, her glasses and throway everything for floor, den use her shoe to physically attack di purser.
Ibom Airline tok say she further attack security officers before dem restrain am and hand her ova to di police.
"She slap her several times and wen di oda cabin crew member try to intervene, she slap her too. She den attempt to forcibly remove di fire extinguisher to use weapon, di act fit damaged and ground di aircraft," di statement tok.
"Di arrival of Ibom Air Security personnel, no stop di passenger as she attack dem as well, lashing out violently at both Ibom Air and FAAN security."
Ibom Airline tok say di airline get zero-tolerance for any violent behaviour or conduct wey go threaten di safety of passengers, crew, or equipment.
Ms Comfort Emmanson neva tok her side of di story.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2
Dis dey happun just days afta di Nigeria Civil Aviation Authority (NCAA) alert federal authorities make dem torchlight and prosecute popular Nigerian Fuji musician Wasiu Ayinde Marshall alias K1 De Ultimate.
For di last development, di NCAA petition di Attorney-General of di Federation (AGF), Lateef Fagbemi and di Inspector-General of Police (IGP), Kayode Egbetokun, make dem do full investigation into wetin happun between K1 De Ultimate and ValueJet officials for Abuja airport on Tuesday.
NCAA say dia investigation find say di musician allegedly violate di Nigeria Civil Aviation regulations.
Kwam 1 trend afta video of im altercation wit ValuJet officials spread for social media.
Di veteran 65-year-old fuji artiste don apologise for di incident.
NCAA authority caution airlines and travellers

Wia dis foto come from, Michael Achimugu/X
Tok-tok pesin of NCAA, Michael Achimugu in reaction to di recent incidents in di aviation sector don list out warnings for passengers and airline, on how dem suppose dey behave wen dem wan travel via air.
We no fit continue to refuse to comply wit air travel regulations. Safety na for all.
We need to improve di speed and quality of response to unruly passenger behaviour and oda security situations and di airports.
You no fit disobey rules for Nigeria wey you dey obey abroad.
Robust ramifications and enforcement actions go become di order of di day.
We go carry out more sensitisation and passenger responsibility education, but we all get di responsibility to do wetin dey right.
All agencies need to look inward and tighten up loose ends.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 3










